'University students gatz declare status or forgo UTME registration' - Jamb

A student writing exam

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) tok say undergraduates wey wan register for di 2026 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) and Direct Entry, gatz first disclose dia matriculation status.

Tok-tok pesin for di examination body Fabian Benjamin for one statement e issue on Wednesday, 28 January, clear am say, di tori wey dey spread say undergraduates no fit write UTME no be true, but di koko na say di candidate gatz disclose im admission status.

Benjamin explain say no be offence for undergraduate to register for di UTME/DE while e still dey enrolled for one institution, but failure to disclose such status na offence.

"For di avoidance of doubt and for record purposes, plus in line wit dia statutory mandate to prevent multiple matriculations, di Board don direct all candidates wey dey register for di 2026 UTME/DE say dem gatz disclose dia matriculation status, wia applicable," Benjamin tok.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Why Jamb ask for disclosure status

Some undergraduates wey wan register for di 2026 UTME raise alarm say one Jamb policy don bar undergraduates from registering for di exam, as one clause dey for di form wey tok say, bifor dem fit register to rewrite di exam, dem gatz forfeit dia previous admission.

In response, Jamb clear am say di reason for di directive na to guide against multiple admissions, wia one candidate go get di option of rejecting an admission offer but decide to accept am to block oda pipo chances.

Di board add say di policy no bar any candidate from applying for UTME afresh, but wetin di clause simply mean na say, di candidate must show evidence of completion or withdrawal from di previous admission bifor securing anoda offer. "No candidate suppose hold two admission offers at di same time".

"Many of dem no dey take time to read or properly understand di guidelines, yet dem go rush go public space wit false narratives wit di sole purpose of attracting traffic to dia social media platforms," Benjamin add.

Wetin be disclosure status?

Jamb compulsory all candidates wey dey register for di 2026 UTME/DE to disclose dia matriculation status, wia applicable.

According to Jamb tok-tok pesin, "disclosure simply mean say once a candidate secure admission through di latest registration, di former admission automatically don cease to stand.

Dis one mean say, di candidate go automatically lose im previous admission.

Di law dey clear say no candidate dey permitted to hold two admissions at di same time, Benjamin add.

E also point say recent findings show say some matriculated students dey engage as professional examination takers.

"Mandatory disclosure, therefore, expedite appropriate action weneva dem catch dose kain candidates," e tok.

Benjamin add say although di board system fit detect prior matriculation, candidates wey fail to disclose stand di risk of forfeiting both opportunities.

Registration for di 2026 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) for di 2026/2027 academic session bin commence on Monday, 26 January.

Di period of registration for UTME candidates including dose from foreign kontris bin start on Monday, 26 January and e go end on Saturday, 28 February.

However, di sales of di UTME application document e-pin bin start on 19 January and go end on Thursday, 26 February.

Registration of di exercise go close on Saturday, 28 February.

For Direct Entry candidates, sales of di application documents and e-pin vending go start from Monday, 2 March and end on Saturday, 25 April.