Chelsea struggle, PSG, Real Madrid late winner and Erling Haaland goal headline champions league night

Erling Haaland late goal against im former club Borussia Dortmund

Wia dis foto come from, Getty Images

Erling Haaland late goal against im former club Borussia Dortmund na im be di highlight of dis week Uefa champions league fixtures.

Di finish see Haaland throw im sef across di ball and acrobatically volley am wit im left leg to beat goalkeeper Alex Meyer.

Di goal begin trend for social media on di night – many pipo say n aim best goal be dat so far dis season for all competitions. Jude Bellingham na im put di German team for front before John Stones equalizer and Halaand winner.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Anoda English side, Chelsea dey at di risk of crashing out of di UEFA Champions League.

Dem bin dey lead 1-0 courtesy of Raheem Sterling but RB Salzburg shock dem wit a late goal by Nigerian - born Noah Okafor for Stamford Bridge.

Di match on Wednesday night na di first game of new coach Graham Potter wey take over from Thomas Tuchel.

Di Blues bin dominate di first half but dem no fit score until Sterling break di defence.

Di result don leave Chelsea for di bottom of Group E afta two games.

Also, Kylian Mbappe become PSG joint leading Champions League goalscorer afta dia win over Israeli side, Maccabi Haifa.

Maccabi score di first goal wit Tjaronn Chery goal in di 24th minute for di Sammy Ofer Stadium.

Goals from Messi, Mbappe and Neymar give PSG win for di game. 

Mbappe goal make im 30th Champions League goal for di club, drawing level wit Edinson Cavani.

For oda games, Napoli hammer Rangers 3-0 for Glasgow. AC Milan also get 3-1 victory against Dinamo Zagreb. Real Madrid score two late goals to beat RB Leipzig 2-0.

Copenhagen and Sevilla end in 0-0 draw while Shakhtar and Celtic also settle for 1-1 draw.