How pipo raise £15,000 around di world to save dog wey get six legs

Ariel

Wia dis foto come from, GREENACRES RESCUE

Wetin we call dis foto, Dem name Airel afta Disney Little Mermaid becos of her partially fused extra back legs wey resemble mermaid tail
    • Author, Nathan Bevan
    • Role, BBC News

Ariel, di six-legged dog wey dem find for supermarket car park, don do surgery to remove her extra limbs.

Di 11-week-old spaniel hit headlines afta dem abandon am outside Pembrokeshire branch for B&M for September.

Na about £15,000 well-wishers raise all ova di world, wey enable am to get di life-changing operation.

Surgeon Aaron Lutchman manage to save all four of her working limbs afta im bin fear say dem fit amputate one.

"She dey do really well, she don bounce back and she dey happy little dog and we dey hope say she go on to get fabulous little life," Mr Lutchman tok.

"She get her own little character and even though she get a tough start for life she don really do well to come through dis... if we fit do wetin we fit do to help den dat go just dey absolutely brilliant."

Mikey Lawlor na di founder and manager of Greenacres Rescue near Haverfordwest, wey take in Ariel afta dem find am alone, skinny and in a state of distress.

"Di vet wey initially assess Ariel note say, in addition to her two surplus back legs, she get additional vulva," di 42-year-old tok.

Im add say CT scan later reveal say she only get one kidney, wey increase di complexity of di medical treatment she require.

"And, Ariel pelvis neva form properly, sake of say she get two hip joints on one side.

"As a result her normal back right leg virtually no get muscle tone, so possibility dey say dem fit comot.

"Tankfully say no be di case though as e dey show signs say e don strengthen dis recent months."

Dem name Ariel afta Disney Little Mermaid character becos of her partially fused extra back legs wey resemble mermaid tail.

Dem operate on Ariel for Langford Vets Small Animal Referral Hospital for Somerset on Thursday.

"Di two procedures last for about two hours, but both dey fine," Mr Lawlor tok.

"Di next day she don stand up, she dey waka around, chop and drink.

"Now we just need to keep our fingers crossed say she no go get any infection, but she dey best hands."

X-ray

Wia dis foto come from, GREENACRES RESCUE

Wetin we call dis foto, X-ray show say Ariel get two hip joints on her right side

Mr Lawlor tok say im dey hope say dem go discharge Ariel dis weekend make she return go home to her foster family for west Wales.

"Den, afta she don get several weeks of physiotherapy and recovery, we go see about finding her forever home," im add.

"Di response we don get to Ariel tori so far, include calls and emails from as far away as New York and Australia, don dey incredible - so I neva doubt say she go snap up.

"I just no fit say enough of tank you to everi one wey contribute to help her."

Langford Vets hospital director Vicki Black add: "Ariel na one complicated little dog wey her care require close collaboration across specialist teams, including orthopaedics, soft tissue surgery, anaesthesia and radiology.

"As part of di University of Bristol our centre dey committed to career-long learning and we dey proud to innovate and treat pets like Ariel.

"We dey happy say such lovely animal don recover well from her surgery."