You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Adolescence dey last to di 30s - new research show four key ages for your brain
- Author, James Gallagher
- Role, Health and science correspondent
- Read am in 6 mins
Di brain dey go through five different phases for life, wit some of di koko turning points by ages nine, 32,66 and 83, according to scientist.
Around 4,000 pipo wey reach di age of 90 do scans to reveal di connections between dia brain cells.
Researchers for di University of Cambridge show say di brain dey stay for di adolescent phase till our early thirties wen we "peak".
Dem tok say di results fit help us understand why di risk of mental health disorders and dementia dey different throughout life.
Di brain dey constantly change due to new knowldge and experience but di research show say e no dey follow just one way from birth to death.
Instead, dis na di five brain phases:
- Childhood - from birth to age nine
- Adolescence - from nine to 32
- Adulthood - from 32 to 66
- Early ageing - from 66 to 83
- Late ageing - from 83 onwards
Dr Alexa Mousley tell di BBC say "di brain dey rewire throughout life, e dey always strengthen and weaken connections and e no just dey follow one steady pattern waaaa, dia go be fluctuations and times of brain rewiring".
Some pipo go reach di landmarks earlier or later dan odas but di researchers say e dey shocking di way dis ages bin clearly stand out for di data.
Na now dem dey reveal dis patterns sake of di number of brain scans wey dey in dis study, wey dem bin publish for di journal Nature Communications.
Five brain phases
Childhood - Di first perion na wen di brain dey sharparly grow in size but e dey also reduce di overabundance of connections between brain cels, wey dme dey call synapses, wey go dey created for beginning of life.
Di brain no dey as efficinet for dis stage. E dey work like pikin wey just dey waka about for park, anywia belle face, instead of to get wia dem dey go straight.
Adolescence - E go change at once from di age of nine, dis na di time wen di connections for di brain dey go through ogbonge efficiency. Dr Mousley say "na huge shift" and call am one of di most profound change between brain phases.
Dis na also di time wia pesin get di greatest risk to start to dey get mental health disorder.
Adolescence dey start around wen puberty dey start but dis na di latest evidence wey suggest say e dey end later dan wey dey tink.
E bin dey thought bifor say na for teenage years di tin dey end but dat na bifor neuroscience sugest say e dey kontinu enta your 20s and now reach early 30s.
Dis phase na di brain only period wia im network of neurons dey dey more efficient. Dr Mousely tok say dis oen give backing to di many measures wey calculate brain fuction peak for di early thirties.
But e also dey "very interesting" say di brain dey stay di same phase between di ages of nine and 32.
Adulthood - Next na period of stability of di prain as e dey go through im longest phase wey fit last for up to three decades.
Change dey slower for dis time wen you compare am to di gbas-gbos from bifor. But na hia, di improvements for brain efficinecy go start to dey backslide.
Dr Mousely tok say dis one "fit di plateau of intelligence and personality" wey many pipo dey witness or don face.
Early ageing - Dis dey start by 66 but e no go just land dey reduce brain power, wetin e dey do na say shifts go start to dey for di patterns of connections for di brain.
Instead of to cordinate as just one whole brain, di organ go start dey sperate fo regions wey dey work tightly togeda. E go be like wen members of band start to dey dodia own solo project.
Even though di study look healthy brains, dis na also di age wey dememtia and high blood pressure, wey dey also affect brain health, go start to dey show.
Late ageing - Den by di age of 83, we go enta di last stage. Dia be less data for dis stage bicos to find healthy brains to scan for hia na im hard pass. Di brain changes resemble early aging but dey even more pronounced.
Dr Mosely tok say wetin really shock am na how di different "ages dey align wit plenti improtant milestones" like puberty, health concerns later in life and even di bif social shifts wey dey happun for di early 30s like parenthood.
'A very cool study'
Di study no separate men and women but questions go dey like wetin di effect of menopause be.
Duncan Astle, professor of neuroinformatics for di University of Cambridge say, "many neurodevelopmental, mental health and neurological conditions ey linked to how di brain dey formed. True-true, differences for brain wiring predict difficulties wit attention, language, memory and different kain of behaviours."
Prof Tara Spires-Jones, wey be director for di centre of discovery brain sciences for di University of Edinburgh tok say, "na very cool study wey torchlight how our brains dey change ova our lifetimes."
She say di result "fit well" wit wetin we understand abour brain ageinf but reason say "no be evribodi go experience dis network changes for exactly di same ages".