Aunty Ramota tok for video afta controversy of alleged BBL surgery

Popular actress, Ramota Adetu, wey pipo sabi as Aunty Ramota

Wia dis foto come from, Aunty Ramota/Instagram

Popular Yoruba Nollywood actress, Ramota Adetu, wey pipo sabi as Aunty Ramota don finally tok afta viral video of her alleged BBL surgery operation bin enta social media.

Recently viral footage ontop internet show di health condition of di popular actress, as she lie down for bed for inside hospital.

Social media users bin tok say she go do BBL surgery to increase di size of her bum-bum.

Footages on di internet show as dem dey carry Aunty Ramota enta hospital room for treatment.

Pipo bin dey believe say Aunty Ramota go do operation for one hospital for Ikorodu make her bum-bum big.

BBC bin report di tori of how social media users dey react sake of di BBL surgery tori.

Aunty Ramota react about her health condition

Aunty Ramota show for video afta di BBL tori

Wia dis foto come from, Aunty Ramota/Instagram

For Wednesday 12 June 2024, Aunty Ramota use her Instagram page to tok about her condition.

For di video, she bin sidon wia she face di camera to tell Nigerians how she be.

She confam say she dey fine and her bodi dey kampe.

“My fans, tank you, na me be dis, notin do me, na my bodi be dis.”

She even turn for camera to show say she no do any BBL and truly no part of her bum-bum bin don increase.

Skip Instagram post, 1
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 1

Skip Instagram post, 2
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 2

Dis no be di first time wey news go spread say Aunty Ramota don undergo surgery on di internet.

Some pipo, especially fans of di actress no believe di news - dem describe am as mere acting for movie role.

Similarly, many of Aunty Ramota colleague believe say di videos and news about di BBL surgery wey Aunty Ramota do na from movie.

Foto of Aunty Ramota

Wia dis foto come from, Screenshot/instagram

Ganiyu Kehinde Morufu, wey pipo sabi as Ijoba Lande tell BBC say im no happy about di news becos na just movie role.

Ijoba Lande na one of di pipo wey dey always follow Aunty Ramota do different contents and movies.

"I dey worry becos I contact Aboki wey dey wit Ramota weda dis na for fun, e tok say na fun," e tok.

"I no fit sleep for night becos wen I first see di news, I no believe am and pipo dey cal me to find out wetin happun.

"Me and Ramota live togada and we dey dey togada many times.

"I try to do research but na in vain. I contact one Ramota friend on Instagram say wetin happun, I beg am make im tell me weda na rumor or true.

"Dis morning, her mama call me to explain everitin wey dey ontop social media.

"I neva see dis bifor. Everitin you dey see na just movie."

Aunty Ramota

Wia dis foto come from, auntyramota_authentic/Instagram

Aunty Ramota biography

Ramota Adetu, wey pipo sabi as Aunty Ramota, dem born am for Ikorodu, Lagos state, in 1981.

She be forty-three years woman, wey dem born wit rare condition wey no make am grow, she look small like pikin.

Aunty Ramota mama die three years ago, and pipo no sabi her papa.

Ramota na Yoruba nollywood actress, and comic content creator.

Aunty Ramota don feature in movies wey include di popular Anikulapo.