Sadio Mane goal seal Senegal qualification to last 16

Sadio Mane late strike help Senegal book dia place for di next round of di ongoing Africa Cup of Nations as dem defeat Cameroon 3-1 on Friday.

Di ex-Liverpool forward cool finish inside injury time snuff out late fight by Cameroon to stage a comeback.

Jean-Charles Castelletto 83rd minute header reduce di deficit for Cameroon afta Senegal bin comfortably dey lead dem 2-0 thanks to goals from Habib Diallo and Ismaila Sarr.

Senegal dominate di match but dem nearly suffer setback late into di game wen Nkoudou fail to find di target wit im header just before Mane put di game beyond Cameroon.

Di defending champions look like di team to beat as dem control much of di match and deny Cameroon from getting any shot on target until dat goal from Castelletto.

Di impressive Ismaila Sarr go dey happy wit di shift im put in as im open di scoring via one deflected shot on 16 minutes.

Sarr become provider later for di second half as im find Diallo wit a cross wey di striker slide in to score Senegal second.

Senegal now get maximum points afta two matches following dia 3-0 victory over Gambia for dia first match.

Cameroon on di oda hand get only one point which dem record for dia draw wit Guinea.

Di Rigobert Song led side must now win dia last group match against Gambia and hope results elsewhere favour dem for dem to progress to di last 16.

Highlights of how di match go

Second Half

FT: Senegal 3-1 Cameroon

Dat goal from Mane take di life out of Cameroon. Defending champions Senegal don book dia place for di last 16 of Afcon 2023 wit dis victory.

90+5 mins - Goal for Senegal! Sadio Mane don put dis game beyond Cameroon wit cool finish inside di area.

Senegal 3-1 Cameroon

90+3 mins - Nkoudou...what a miss. Di Cameroon winger fail to find di target wit im header.

90+1 mins - Cameroon coach Rigobert Song play im final card. Im don bring on Junior Tchamadeu, Tchato Mbiayi don comot.

90 mins - Senegal player Lamine Camara no fir kontinu di match, e be like e don get injury. Stretcher don carry am comot afta e receive treatment. Pathe Ciss don take im place.

Both teams now get seven minutes of additional time.

86 mins - Cameroon almost get di equaliser through Nkoudou. Castelletto send di ball into di box and Senegal fail to clear but Nkoudou stretched leg no reach di ball. What a chance for Cameroon.

83 mins - Goal for Cameroon! Castelletto rise high to head Ntcham cross beyond Mendy. Game on!

Senegal 2-1 Cameroon

81 mins - Diallo no go fit kontinu dis match. Him and Ismaila Sarr don leave di pitch, Iliman Ndiaye and Nicolas Jackson don enter di game.

79 mins - E be like Neyou game don end through injury afta e collect dat yellow card. Olivier Ntcham don take im place.

Meanwhile Senegal goalscorer Diallo don come off on a stretcher.

75 mins - Anoda yellow card for Cameroon, dis time na Neyou collect di yellow.

74 mins - Substitutions now for both teams.

Pemi Moumbagna don replace Ngameleu for Cameroon while Idrissa Gueye don take di place of Pape Sarr.

70 mins - Goal for Senegal. Habib Diallo double dia lead! Cameroon defence just stand dey watch as Sarr send in low cross into di box, Diallo stretch im leg and send di ball into di net.

Senegal 2-0 Cameroon

68 mins - Senegal nearly gift Cameroon a chance. Mendy fumble Tchato cross into Koulibaly but go dey happy to see di ball go out of play for cornerkick.

65 mins - Cameroon fans inside di stadium no dey happy wit dia team afta dem send one set-piece cross straight out of play. Di Indomitable Lions never get one single shot on target for dis game.

62 mins - Ismaila Sarr break clear on di right inside promising move for Senegal, di winger cross find Habib Diallo but di referee stop di move as di forward control di cross wit e hand.

58 mins - Abdou Diallo don collect needless yellow card for denying Cameroon a quick restart of di match.

56 mins - Nouhou wit a good tackle to deny Senegal from getting a clear chance at goal. Di defender wey be di last man celebrate di tackle like say e score.

53 mins - Senegal wit free-flowing football now as dem move di ball from side to side. Diallo hold di ball well for midifield, e give Camara down di left and di midfielder try to spray di pass to Sarr for im righ. Di winger first time cross dey power as e go towards di goalkeeper instead of im teammate.

48 mins - Castleletto don enter di ref notebook afta im use e elbow foul Diallo. Two yellow cards now for Cameroon.

46 mins - Di match don resume, upto Cameroon now to find di equaliser.

First Half

HT: Senegal 1-0 Cameroon

Ismaila Sar only goal separate di sides. Di winger score just afta 16 minutes to give di defending champions di lead.

45+3 mins - Yellow card for Olivier Kemen of Cameroon. Di defender bring down Sarr.

45 mins - Senegal look comfortable as Cameroon never really test dia defence. Referee Mahmood don add four more minutes before half-time.

40 mins - Senegal try to play route one football wit a ball ova di top for Mane, Onana read di game well as im rush out of im box to clear di ball and deny Mane one-one chance.

38 mins - Chance for Mane to increase Senegal lead...Christopher Wooh put body behind e shot to block di forward attempt.

36 mins - Onana try to quickly start Cameroon attack wit a dropkick. Di ball beat all di Cameroon attackers den go straight into Mendy hands.

30 mins Krepin Diatta send in fine cross into Cameroon box, Onana rush out to punch am clear. Senegal look very quick on di counterattack, Cameroon need to dey careful as dem dey push forward to try find di equaliser.

21 mins - Cameroon need to stay calm and get back into di game. Since di goal go in dem don begin lose possession of di ball.

16 mins - Goal! Cameroon fail to clear di corner-kick, di ball fall to Ismaila Sarr wey shoot di ball past Onana into di net. Di shot bin take small deflection.

Senegal 1-0 Cameroon

15 mins - Lamine Camara try to surge into di Cameroon box so as to create sometin but di Cameroon defence clear di ball out for corner-kick.

10 mins - Mane receive di ball down di left, e come try to dribble im way past di defender. Referee blow im whistle say Mane bin dey offside.

Today referee, Ali Mahmood come from Sudan.

6 mins - Cameroon don begin show say dem really need dat first goal as dem camp for Senegal half. Dem need dat early goal to boost dia confidence.

3 mins - Cameroon don start well so far. Edouard Mendy already don push out one fine cross Nkoudou.

1 min - Di first half don start. Senegal 0-0 Cameroon.

Senegal vs Cameroon lineup

Senegal XI: Mendy, Diatta, Koulibaly, Diallo, Jakobs, Camara, Sarr, Gueye, Sarr, Diallo, Mane

Cameroon XI: Onana, Castelletto, Wooh, Tchato, Tolo, Neyou, Kemen, Zambo, Nkoudou, Magri, Ngamaleu