You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Trump UK visit in fotos as King Charles and senior royals welcome am to Windsor Castle
US President Donald Trump state visit to di United Kingdom dis week don begin as e meet wit di royals.
Di King and Queen as well as oda senior royals welcome President Trump to Windsor Castle.
Na im second state visit to di UK and e dey accompanied by di usual pomp and pageantry.
Di scale of dis ceremonial for Windsor don step up, wit 1,300 troops and 120 horses wey dey involved and e dey far more dan di one wey dem use wen President Macron of France visit earlier dis year.
During di visit, First Lady Melania Trump wear black outfit, U.S. President Trump wear black suit wit burgundy tie, King Charles III wear suit too wit blue patterned tie and Queen Camilla wear blue dress.
See some of di ogbonge moments for fotos: