All we know about Tanzania plane wey crash and kill 19 pipo

More updates and informate don dey come out afta one Tanzania passenger plan crash land enta di Lake Victoria near di north-western town of Bukoba.

Authorities don canfam say 19 pipo die afta di Precision Air flight wey bin carry 43 pipo crash-land for water.

Earlier, Authorities bin say only 26 passengers na im dem rescue, while 14 odas still dey stranded but rescue operations continue to go on.

Di goment don temporarily close di Bukoba airport until further notice. 

Before now, Kagera Regional Commissioner, Albert Chalamila wey bin tok to tori pipo, say dem dey able to communicate with pilots by phone from di cockpit. 

According to Chalamila, all di passengers wey dem rescue don already dey admitted for di regional hospital for further checkup.

Presently, Tanzania Prime Minister, Kassim Majaliwa wey arrive di scene today afternoon confam di deaths of 19 pipo and say di pilots wey bin speak with officials from dia cockpit fit dey among those wey die. 

 “We still dey identify di bodies, but e dey highly likely say di pilots fit don perish,” Majaliwa tok.

Di PMtok say goment teams and aviation experts are dey on dia way to Bukoba and dem go conduct intensive investigation to identify wetin cause di truly cause di accident even with early reports wey don come out.

Di Precision Air flight wey crash inside water bin dey travel from Dar es Salaam dey go Bukoba via Mwanza dis morning with 43 pipo, wey 39 of dem na passengers.

Fotos and video from di scene show say di plan don almost enta water finish with only di brown and green bottom wey dey show ova water.

Tanzania President, Samia Suluhu don tweet to express her sorrow to those wey dey affected.

Di President call for calm and prayers as di rescue operation continue.

How di plane crash happun and wetin cause am

Di Precision Air flight bin dey on dia way to tdi northern lakeside city of Bukoba from di commercialcapital Dar es Salam.

And e bin dey only 100 metres from di airport wen e crash inside water.

Authorities dey blame bad weather as di cause of di accident.

Precision Air na Tanzania largest private airline and dey partly owned by Kenya Airways.

Dem found am for 1993 and di airline dey operate domestic and regional flights to popular tourist destinations.

Di destnation wey di airline dey try mostly go na like di Serengeti National Park and di Zanzibar archipelago.b