Senegal advance as Ecuador suffer defeat

Kalidou Koulibaly ogbonge goal send Senegal enta di World Cup knockout stages for di second time for dia history.

Dis na as dem comot Ecuador from di competition for di rowdy Khalifa International Stadium.

All di three goals for dis game bin come from players wey dey based for England as Ecuador Brighton midfielder Moises Caicedo bin equalize afta Watford

Ismaila Sarr penalty and before Chelsea defender Kouliabaly finally win am for di African side.

Ecuador bin need just one point from dis match to progress to di knockout. But dem pay di price for dia passive display even as Senegal supporters bin dey ginger dem with consistent drumming.

Watford winger Sarr bin stroke home from di spot afta di Ecuador defender Piero Hincap try bounce am wey but di African champions ahead.

Ecuador bin draw for dia first real chance as Caicedo score with Felix Torres assist.

But Kooulibaly jeje finishing sharp-sharp give Senegal lead. As na only victory fit make dem enta round of sixteen except Qatar beat di Netherlands wey no dey likely.

Dem hold di lead for six minutes of stoppage time wey bin make pipo bite nails to finish as di runner up fo Group A behind di Dutch, wey bounce di host kontri Qatar with comfortable 2-0 win for Al Khor.

Aliou Cisse side fit be di last 16 opponents for England as di Lions of Teranga fit face di winners of Group B wey fit be di Gareth Southgate side if dem seal di win on Tuesday.

How di match go

First Half

Here we go!

Di crucial, final game in Group A don start

2 mins' Ecuador dey try make a quick start as dem push upfield and Gruezo looks for Valencia through di middle. Koulibaly cut am out sharparly.

4 min' Chai! Ogbonge chance for Senegal

Idrissa Gueye run go cross field pass on di edge of di Ecuador box, drive into di area but den skew imshot wide.

10 mins' Ecuador win free-kick for midfield, and na long way out, but Valencia dey shaping to shoot. E keep am low, drill am under di wall, but e pinballs through di crowd on di edge of di box and Diallo clear am gbas.

12 mins' CLOSE! Ecuador lose out again here and Senegal dey jolly down di right side. Ndiaye cut inside, leaving Estupinan behind and e try curl im shot into di far top corner, but e just dey too wide.

19 mins' Idrissa Gueye dey playing for number 10 position for Senegal and e dey do beta job e win one corner out of nothing.

 Senegal don win both of dia previous meetings with Ecuador in all competitions, winning friendly matches in May 2002 (1-0) and December 2005 (2-1).

22 mins' Again, Ecuador look to dia right side to make something happun and Plata try to tee up Valencia through di middle.

32 mins' Ecuador dey happy to just keep possession in front of Senegal. Dem no dey any hurry to push upfield and dey coping well with Senegal's press.

As e be now

As Netherlands don score against Qatar, da means say na dem dey top of Group A.

E currently mean say Qatar go be di first host nation to finish with zero points.

34 mins' Senegal still dey struggle to get touch di ball at di moment. Valencia bin try to take am around Koulibaly down di left, but na perfectly-timed tackle from di defender to stop am.

36 mins' Senegal win one free-kick down di right and Jakobs swing anoda dangerous cross into di box. Ciss rise highest to flick one header on, but di tin loop onto di roof of di net.

37 mins' Touch of panic for both ends. Kalidou Koulibaly loose pass across di face of di Senegal area dey almost collected by Michael Estrada.

Den up for di other end Hernan Galíndez dey out to dive for di feet of Boulaye Dia to save di day for Ecuado

42 mins' PENALTY to Senegal

Goal!!!!!!!!! Sarr net di penalty fo Senegal

Half Time Ecuador 0-1 Senegal

As e be now

Dat Sarr penalty completely change di complexion of Group A. Senegal currently dey progress to face di winners of Group B for di round of 16.

SECOND HALF

46 mins' KICK-OFF

E don start again! Na Senegal get us back underway for di second half

48 mins' Ecuador don make one bright start to di second half, and dem dey keep Senegal penned back for dia own half. Cifuentes find pocket of space on di edge of di box, but im low shot na straight to Mendy.

50 mins' Ecuador win anoda free-kick, dis time na down di left, and Preciado swing one deep cross into di box. E dey over for everyone for di middle though, and e bounce harmlessly wide.

60 mins' Mendy go long wit a free-kick and Sarr win anoda one after Preciado trip am. Jakobs swing anoda good cross into di middle, but Hincapie head amaway

62 mins' Ecuador no just fit hold di ball at di moment and Sarr win anoda free-kick to ease di pressure on im team-mates. Na poor delivery from Pape Gueye though and Ecuador clear dia lines.

67 mins' Goalllllll

Caicedo score equalise for Ecuador

70 mins' Goal!!!!!!

Koulibaly retake lead for Senegal

SAVE!

Na clever bit of play from Sarmiento as e dribble past two defenders on di right to clip am into di far post. Preciado nods am into Plata, who get am out of im feet before drilling am straight at Mendy.

Caicedo na di youngest player to score for Ecuador for World Cup match (21y 27d).

SIX MINUTES ADDED

90 + 5 mins' Substitution

Senegal dey bring on one defender to help dem see out dis win. Dia is being helped off the field quicker by Caicedo, as Cisse comes on in his place.

90' + 8 mins' FULL-TIME

SENEGAL DON ADVANCE

THE FINAL GROUP A TABLE

Netherlands win di group.

Senegal don progress.

Ecuador don comot.

Qatar na officially di worst performing men World Cup hosts ever.

Team squads

Senegal XI: 16 Mendy, 21 Sabaly, 3 Koulibaly, 14 Jakobs, 22 Diallo, 11 Ciss, 26 Gueye, 13 Ndiaye, 5 Gueye, 18 Sarr, 9 Dia

Senegal XI: 1 Galindez, 17 Preciado, 2 Torres, 3 Hincapie, 7 Estupinan, 8 Gruezo, 21 Franco, 23 Caicedo, 19 Plata, 11 Estrada, 13 Valencia

Team news

Ecuador get hope as captain Enner Valencia, wey bin score all di goals dem play for dis World Cup, go play at least some part for di game despite say knee injury force am out of di pitch against di Netherlands.

Senegal no get new injury concerns.

Match facts

  • Dis na Ecuador first World Cup match against African nation. Opponents Senegal neva win for both of dia previous World Cup games against South American sides, and di two previous games na final group game of tournament (3-3 against Uruguay for 2002, 0-1 against Colombia for 2018).
  • If dem avoid defeat, Ecuador go qualify for di knockout stages of di World Cup for di second time for dia history, sometin wey dem do for 2006. E go also be di first time dem no beat dem for entire group stage.
  • Enner Valencia don score six World Cup goals for Ecuador, more dan any oda player (Agustin Delgado get three). Im score di six goals from just nine shots on target.
  • Valencia don also score each of Ecuador's past six goals for di World Cup, di first player to do am for a single nation since Oleg Salenko for Russia for 1994. E fit become di first player for di World Cup history to score seven goals in a row for a nation.