You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Morocco beat Portugal to set new record for Africa and Arab for World Cup history
Di Atlas Lions of Morocco don set new record for World Football as di first African kontri to qualify for di semi-final of di Fifa World Cup.
Di North African kontri set di record afta dia hard earned victory over Portugal for di Qatar 2022 quarter final match.
Di match hold for di Al Athumama stadium wia Morocco beat Portugal 1-0.
Coach Fernando Santos bin bench captain Cristiano Ronaldo – e retain di same team and formation wey e use beat Switzerland 6-1 for di round of 16.
But di Moroccans shock Portugal wit a 42 minutes gaol by Youssef En Nesyri.
Dem later change dia formation to begin play defensive game to endure di pressure of attacks from Ronaldo and im men.
Wit di win Morocco don become di third kontri to qualify for di semi-final of di 2022 Fifa World Cup joining Croatia and Argentina.
Second Half
Full-Time Morocco 1-0 Portugal
End of Di one wey oda users dey read well well
EIGHT ADDED MINUTES
90mins RED CARD
Morocco down to 10 men as Walid Cheddiratwo yellow cards within di space of 60 seconds.
89mins Chance for Cristiano Ronaldo but Bono keep im composure.
Portugal dey running out of time. Morocco dey coast to victory
86mins Corner kick for Portugal but Morocco push am out.
81mins Santos no look too happy wia e dey siddon for di bench
80mins Morocco tanda gidigba and try to keep Portugal at bay.
79mins SUBSTITUTION
Portugal carry another attacker enter- Ricardo Horta for José Diogo Dalot
74mins After Silva no fit make sufficient contact forFernandes free-kick from di left touchline, Morocco temporarily get di ball away, but dat one sef no last as Portugal soon enough descend again; penning back di entire Moroccan XI inside dia defensive third.
70mins YELLOW CARD
First yellow card of di match go to Achraf Dari for im tackle on Leao for di right flank
65mins SUBSTITUTION
Morocco subtitutue dia goal scocer Youssef En-Nesyri wit Badr Benoun
60mins Fernandes shoot one free-kick from central position into di box, but one Morocco defenders head am away.
Morocco dey 30 minutes from becoming di first African side to reach di semi-finals of di World Cup. Dem fit do am?
58mins CLOSE!
Chance for Goncalo Ramos but di hat-trick hero against Switzerland plant im header wide. Dat na great opportunity to equalise but e no work!
57mins SUBSTITUTION
Bad news for Morocco. Dia captain Romain Saiss no fit continue.
Im replacement na Achraf Dari wey dey make im fifth senior appearance for im kontri.
Im job na to stop Cristiano Ronaldo!
51mins SUBSTITUTION for Portugal
Cristiano Ronaldo enta di pitch for im196th cap to replace Ruben Neves. Joao Cancelo for Raphael Guerreiro
46mins Portugal win first corner within di opening 90 seconds of di second half but e no gel
45mins KICK-OFF
First Half
Half-Time Morocco 1-0 Portugal
Di Atlas Lion dey 45 minute away from a place for di semi-final.
42mins Goal!!!!!!! Morocco 1-0 Portugal
Youssef En-Nesyri give Morocco lead
31mins CLOSE! Joao Felix has look sharp going forward and e almost unlock di Moroccan defence with one first time shot wey deflect off Jawad El Yamiq and fly narrowly over di bar.
Corner to Portugal.
Meeting one dropping ball with a driven half-volley from the edge of the box, Joao Felix sees his goalbound effort blocked at close range by El Yamiq, who had previously failed to clear his lines. That was a rare opening in this first half for the Selecao!
23mins Bruno Fernadenz knock head wit Morocco keeper
21mins Morocco win second corner but no show at di end
20 mins No show, no goal from either sides so far
15mins Portugal so far for dis match donhold 79 per cent possession.
12mins Free-kick for Portugal.
9mins Joao Felix almost escape for di left-hand side of di area, but e loose touch as e dey try to trap one sweeping crossfield ball wey allow Hakimi to intervene.
7mins Morocco respond sharparly with attack of dia own wey end with chance flying over di bar but na offside e be.
6mins Ogbonge chance for Portugal!
One free-kick land for Morocco box and Joao Felix force Bono into flying save.
3mins Whistles ring around di stadium as di Moroccan fans object to an early spell of Portuguese possession. Di Selecao dey carefully keep di ball inside dia own half.
1min KICK-OFF
Morocco vs Portugal line ups
Morocco: Bono, Hakimi, El Yamiq, Saïss, Attiat-Allah, Ounahi, S Amrabat, Amallah, Ziyech, En-Nesyri, Boufal.
Portugal: Diogo Costa, Dalot, Pepe, Rúben Dias, Guerreiro, Bernardo Silva, Neves, Otávio, Bruno Fernandes, Gonçalo Ramos, João Félix
Morocco vs Portugal team news
Walid Regragui fit miss di services of West Ham defender Nayef Aguerd afta di player suffer injury during di game against Spain.
Romain Saiss and Sofyan Amrabat also remain doubtful to make di starting lineup due to injury concerns.
Portugal all-time leading goal scorer and captain Cristiano Ronaldo dey bench once again.
Dis na becos coach Fernando Santos fit wan stick to di same lineup wey e use beat Switzerland.
Goncalo Ramos gp play di game wit Morocco wit plenty of confidence afta e score hat-trick for di big 6-1 win.
Nuno Mendes and Danilo Pereira remain doubt to play a part in di game – as e be, Ruben Dias go continue to pair Pepe for back.