Wetin dey cause Typhoons and Hurricanes?

Pesin dey stand outside wia hurricane Ian don scata

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, How Hurricane Ian scata pesin house for Cuba

Right now, Hurricane Ian don dey enta Florida for di US and sabi pipo say e be like say di storm dey climb to a category five even as two pipo die for Cuba for di storm.

Last week, na Hurricane Fiona wey be Category 4 storm pass through Puerto Rico, as e pass Turks and Caicos Islands and Bermuda.

At di same time Typhoon Noru kill ten pipo as e tear through di Philippines and don dey make im way inside Vietnam.

As all dis one dey happun, authorities for di region don dey try move pipo out of di area of impact.

So wetin dey cause dis kain weather wey dey destroy lives and property?

Cause of Typhoons and Hurricanes

Satellite Images as dem dey track Hurricane Ian

Wia dis foto come from, NOAA

Wetin we call dis foto, Satellite Images as dem dey track Hurricane Ian

Weda na Hurricane, Cyclone or Typhoon, all of dem na di same weather disaster, but dem dey call dem different name, depending on which area e happen.

Na storm wey dey spin and warm air dey feed am.

Di scientific name for all dis storms na tropical cyclones and dem dey come wit strong winds and heavy rains.

If na for Atlantic ocean or North East Pacific ocean e happen, then dat na Hurricane. Wen e happen for South Pacific and Indian ocean, dat one na Cyclone.

But wen na for Northwest Pacific di storm dey disturb, then dat na Typhoon.

Dem dey form ova warm oceans and dey gada energy as warm air dey carry water dey rise dey go.

As di warm ocean air dey rise, e go start to cool down and na wetin dey form clouds wey dem dey call area of high pressure.

As dis air dey rise, e mean say air no go plenti for di ocean surface again wey dem dey call area of low pressure.

More air go come move dia to fill di gap of di low pressure.

Dat air go come warm and rise wey go cause di spinning cycle as more air dey try fill fat space and as more warm air dey climb up and cool down, more clouds go form.

Dem be very strong storm wey dey carry heavy wind, heavy rain flood and mudslide follow bodi.

Usually, storm season dey start for April, then e go end for December.

Climate change dey make mata worse

One April 2022 study wey study di 2020 North Atlantic hurricane season reveal say dat period bin get one of di most active seasons on record.

Di study report say na di effects of climate change wey create hotter atmosphere dey cause heavier rainfall with the storm.

Di study wey appear for di journal Nature Communications record say di hourly rainfall rates during hurricane storms don increase by 8%-11%.