Two dey miss afta flood carri dia car for Lagos

Foto wey show di car inside floods

Wia dis foto come from, James Joel

Lagos State goment don tell sorry to residents over heavy flash flooding wey dem experience for several parts of state, including Oko-Oba, Agege.

Dis na afta two pipo miss wen flood carri dia car for Oke Oba, Agege area of Lagos, south west Nigeria on Saturday, 9, July, 2022.

E happun afta early morning rain fall for Lagos and cause heavy flooding for some streets for di area.

Inside statement wey di Commissioner for Environment and Water Resources, Tunji Bello sign, dem ask residents to dey vigilant and careful.

Eyewitness tok say di flood bin hook two cars wit passengers inside di car.

Official from di National Emergency Management Agency, Nema say dem rescue four pipo alive from inside di cars wey flood worry.

Di car bin hook for inside flood wey heavy rain cause for di Agege area of di state around Fatoki area, di authorities tok.

Report say na six pipo di water bin carry enta one uncompleted canal for di area.

Lagos State Fire Service wey dey lead di rescue operation alongside oda emergency agencies for di state also say three pipo bin dey inside one Lexus and three odas dey inside di oda car.

 “Dem bin dey adamant and drive through and di water sweep dem away”

Search and rescue operations still dey go on to find di two pipo wey still dey miss." Dem tok earlier.

'Narrow escape'

Di two vehicles bin get three pipo each on board. For inside di Lexus, one pesin swim comot di vehicle while residents epp di oda two pipo out.

Statement from Nema wey BBC Pidgin sight say one of di pipo wey dey inside di Toyota refuse to drop down from di vehicle, di oda two pipo drive comot and na dem dey miss.

One eye witness tell BBC Pidgin say na one man wey take di risk of diving inside di floods also help to save dem.

"Dem throw rope give am and e try to tie am to di car, na how dem survive."

"Di occupants of di Lexus na only one survive, di oda two, up till now, we never see dem." E tok.

Di eyewitness add say dem dey build canal for di area and di construction dey slow.

'Heavy rains go continue till di end of August'

Lagos road dey flooded afta downpour on Saturday
Wetin we call dis foto, Lagos road dey flooded afta downpour on Saturday

For April, Lagos State goment bin don warn residents to dey at alert of heavy rains wey go amount to 1,750mm in 2022.

Afta di incident, goment say di flash flooding wey some areas, especially old Oko-Oba Road, experience na as a result of di ova10 hour-rainfall wey overflow di Oko-Oba Canal Channel wey presently dey undergo expansion.

“Dem dey expand di Oko-Oba Canal for Agege to allow for di containment of more stormwater to reduce flooding in di area”.

Bello also advise motorists and residents to exercise caution while dem dey pass flood areas during heavy rainfall because of di danger.

E add say di expansion project pause due to di heavy rain within di past few weeks.

Bello add say becos Lagos na coastal city, e go experience flooding during heavy downpour, especially in cases of di type of heavy rainfall wey happun in di last 36 hours.

E also appeal to Lagosians to remain cautious as di heavy rains go continue until di end of August.

“All those wey dey depressed and low-lying areas in di State at dis period must dey careful of di water level and ready to move to high areas during di rainfall to safeguard lives and property”, e tok.

More fotos of how flood affect Lagos and environ on Saturday

Flood for Opic estate area
Wetin we call dis foto, Flood for Opic estate area
Foto show how flood cari motor

Wia dis foto come from, Jame Joel

Wetin we call dis foto, Foto show how flood cari motor
Agege area dey flooded afta rains

Wia dis foto come from, James Joel

Lagos road dey flooded afta Saturday rains
Wetin we call dis foto, Lagos road dey flooded afta Saturday rains