Katsina govment confam say na 32 pipo bandits kill wen dem dey pray for mosque

Wia dis foto come from, Dr. Dikko Umaru Radda/Facebook
Katsina State govment don confam say na 32 pipo bandits kill for Unguwar Mantau, Malumfashi Local Govment Area of di state.
Di state govment yarn dis one on Wednesday 20 August afta dem send one delegation to go condole families of di victims.
Dia earlier report through di Commissioner for Internal Security and Home Affairs, Dr. Nasir Mu'azu, bin say na '13 residents lose dia lives during morning prayers' wey di attack take place.
"Di incident bin occur wen criminal elements launch reprisal attack on di community. Di Muslim members of di community bin dey pray for di mosque during di Fajr prayer wen di criminal element bin start dey shoot anyhow for di mosque," di commissioner tok.
E say di attack na retaliation sake of di 'successful defence efforts' wey di community do two days bifor wia di "pipo of Unguwan Mantau decide to lay ambush against di bandit and kill many of dem.
Di commissioner say di community residents bin rescue di victims wey di bandits don take from Ruwan Sanyi village and recover motorcycles.
"Di security agencies now dey on ground for Unguwan Muntau to restore normalcy.
"Nigerian Army, and Nigerian Police Force don alreadi deploy to clear dose bandits becos during di rainy season, bandits dey hide under di crops to do dia evil acts," e tok.
For di latest development on di attack, di state govment for one statement by di media directorate say di delegation wey di Secretary to di State Govment, Barrister Abdullahi Garba Faskari, bin lead, assure di community say govment no go tire for di work to strengthen security and bring peace wey go last.
“Our hearts dey wit di families wey lose loved ones for dis senseless attack. Dis administration dey committed to work with all di security agencies to make sure justice go happun and stop dis kain tragedy for future, e tok.
Dem say dem still dey verify di number of pipo wey di bandits kidnap.
Di delegation say di Nigerian Air Force bin disrupt di bandits wen dem bin dey move wit captives.
"Inside di confusion, some victims scata go different directions, while odas bin dey rescued and now dey receive treatment for hospitals," di statement tok.
Eyewitness tok wetin im sabi

Wia dis foto come from, JORIS BOLOMEY/AFP VIA GETTY IMAGES
One resident wey follow BBC News Pidgin tok on Tuesday 19 August say na 25 worshippers di bandits kill and na five pipo dem injure.
Di eyewitness wey no want make we mention im name say di attack happun around 6am for morning afta pipo finish dia Fijr prayer.
"Around 5:45am, di gunmen meet pipo for mosque afta dem finish Fijr prayer, dem just open fire on dem.
"Na immediately 25 pipo die, and more dan five odas injure, dem dey receive treatment for Katsina hospital now," e tok.
E add say wen di attack dey happun, dem no get any help from security pipo.
"Na afta di gunmen finish to kill pipo bifor security officers come. Dem snap picture and within two hours, dem don waka comot," e tok.
E add say since afta di attack, pipo dey live for fear, and some don run comot from di community to save dia lives.
"As I dey tok to you now, all my family no dey house again, dem don run comot for di community, pipo wey remain no plenti," e add.
Di resident beg di state govment and security pipo make dem help bring peace for dia community.

Wia dis foto come from, Ibrahima Kaulaha Mohammed/Facebook

Wia dis foto come from, Ibrahima Kaulaha Mohammed/Facebook

Wia dis foto come from, Ibrahima Kaulaha Mohammed/Facebook










