All you need know about di 2025 Ballon d'Or, who be di favourites to win di awards?
- Author, Michael Emons
- Role, BBC Sport journalist
- Author, Adam Millington
- Role, BBC Sport journalist
- Read am in 9 mins
Di day wey footballers and fans of di round leather game dey always wait for evri year don come.
On Monday dem go crown di best male and female football players for di world.
E go be di winners of di two Ballon d'Or awards - sake of dia performance last season.
Dem go announce di winners for ceremony wey go happun for di Theatre du Chatelet for Paris, France.
But who, out of di 30 nominees wey dem bin announce last month dey most likely to win di award?
We don analyse how six of di ogbonge contenders for each prize bin perform last season.
We use statistics from 2024-25 - across all club competitions for di men and all league matches for di women.
Ousmane Dembele (Paris St-Germain)

Wia dis foto come from, Dan Mullan/Getty Images
Games wey im play: 53 Minutes im play: 3,483 Goals: 35 Assists: 14 Goal contributions: 49 Minutes per goal: 99.5 Minutes per goal contribution: 71.1
Ousmane Dembele play key role as im help Paris St-Germain win Ligue 1 and become European champions for di first time. Dem also reach di final of di Club World Cup.
Im bin score 21 goals from 29 games for Ligue 1 to end di campaign as joint-top scorer.
Dem also name am for di division team of di season and im win di player of di year award.
Di 28-year-old na also di Champions League player of di season afta eight goals and six assists for di tournament, wey include two assists for di 5-0 final win against Inter Milan.
Dembele score di Club World Cup quarter-final and semi-final victory ova Bayern Munich and Real Madrid.
Harry Kane (Bayern Munich)

Wia dis foto come from, Ulrik Pedersen/NurPhoto via Getty Images
Games wey im play: 51 Minutes wey im play: 3,955 Goals: 41 Assists: 12 Goal contributions: 53 Minutes per goal: 96.5 Minutes per goal contribution: 74.6
England record goalscorer claim di first major trophy of im career wen im bin inspire Bayern Munich to win di Bundesliga title.
Di 32-year-old score 26 league goals to top di Bundesliga scoring charts, wey include three hat-tricks.
For September, im bin scored 10 goals for 11 days, im bin start with two for England against Finland for di Nations League on 10 September.
Im score anoda three for Bayern Munich 6-1 league victory on Holsten Kiel three days later.
Im score four goals for Bayern Munich 9-2 Champions League match wey dem thrash Dinamo Zagreb on 17 September and one for im club 5-0 win for Werder Bremen on 21 September.
Kylian Mbappe (Real Madrid)

Wia dis foto come from, Maria Gracia Jimenez/Soccrates/Getty Images
Games im play: 59 Minutes im play: 4,742 Goals: 44 Assists: 5 Goal contributions: 49 Minutes per goal: 107.7 Minutes per goal contribution: 96.8
Di France forward end im first season for Spain as di top goalscorer for La Liga, im tally of 31 goals use four goals pass Robert Lewandowski of Barcelona.
Mbappe total bin come from 34 matches wey include hat-tricks against Valladolid and Barcelona. Im bin also score three goals wey remove Manchester City for di Champions League knockout play-off round.
Di 26-year-old becom di only di third player to score 50 goals for France, im reach dis figure for June wen im bin help im kontri finish third for di Nations League.
Raphinha (Barcelona)

Wia dis foto come from, Angel Martinez/Getty Images)
Games im play 57 Minutes im play: 4,661 Goals: 34 Assists: 22 Goal contributions: 56 Minutes per goal: 137.1 Minutes per goal contribution: 83.2
Raphinha bin help Barcelona win three trophies for di 2024-25 season - dem win di La Liga, di Copa del Rey and di Supercopa de Espana.
Im 18 goals and nine assists give am di La Liga player of di season award.
Di 28-year-old Brazil forward, wey move to Barcelona from Leeds United for 2022, also end as di joint-top scorer for di Champions League.
Im score 13 times for 14 games wey include hat-trick for dia 4-1 win over Bayern Munich.
Mohamed Salah (Liverpool)

Wia dis foto come from, Reuters
Games im play 52 Minutes im play: 4,497 Goals: 34 Assists: 23 Goal contributions: 57 Minutes per goal: 132.3 Minutes per goal contribution: 78.9
Mohamed Salah play big role wey help Liverpool becom di English champions for di 20th time.
Im 29 goals and 18 assists give am a total of 47 Premier League goal wey im dey involved in, e bring im record for di highest for 38-game season.
Im goals tally bin also give am di Golden Boot - di fourth time wey im don win am, im dey share di record wit Arsenal legend Thierry Henry.
Dem bin also name di 33-year-old as di Premier League player of di year for a second time.
Di Egypt forward bin score three times for di Champions League bifor Liverpool lose to eventual winners Paris St-Germain for di last 16.
Lamine Yamal (Barcelona)

Wia dis foto come from, Nurphoto/Getty images
Games im play: 55 Minutes im playe: 4,548 Goals: 18 Assists: 21 Goal contributions: 39 Minutes per goal: 252.7 Minutes per goal contribution: 116.6
Di winger wey dey 18-years help Barcelona to di Spanish treble of La Liga, di Copa del Rey and di Supercopa de Espana.
Im bin win La Liga player of di month award for September and im bin also dey for di La Liga and Champions League teams of di season.
Im score two times for Spain for dia 5-4 win over France for di Nations League semi-final, even though dem still lose on penalties for di final to Portugal.
Aitana Bonmati (Barcelona)

Wia dis foto come from, pedro Salado/Getty Images
Games she play: 26 Minutes she play: 1,913 Goals: 12 Assists: 6 Goal contributions: 18 Minutes per goal: 159 Minutes per goal contribution: 106
One of di two Barcelona and Spain players wey fit lift di Ballon d'Or for di third time, but di only one wey fit do am for three years back to back..
Dem no dey argue say Aitana Bonmati na one of di best players for di world and e no go surprise pipio if she win am again - but she bin miss out on two major trophies wey fit no help her cause.
Pipo bin no dey sure about her ability to play for di Euros wen she bin dey for hospital sake of meningitis just days bifor di tournament start, but she bin played important role for Spain, including di winning goal wey she score for di semi-final.
She no be di best player for di knockout stage as oda players bin shine pass her and England win di final.
Alessia Russo (Arsenal)

Wia dis foto come from, Visionhaus/Getty Images)
Games she play: 21 Minutes she play: 1,686 Goals: 12 Assists: 2 Goal contributions: 14 Minutes per goal: 141 Minutes per goal contribution: 120
Na beta year for di Champions League winner and Euro 2025 winner for di Arsenal striker.
She score for di final of di Euros and and she dey also play beta football for her club. She play important role throughout di season for front of goal and wit her wey she dey do wit di ball.
Di 26-year-old na di Football Writers' Association's women's footballer of di year for last seasonand dem give her di award for good reason.
She also be di Women Super League joint-top scorer, she dey share di Golden Boot wit Khadija Shaw.
Alexia Putellas (Barcelona)

Wia dis foto come from, Quality Sport images/Getty Images
Games she play 24 Minutes she play: 1,620 Goals: 16 Assists: 11 Goal contributions: 27 Minutes per goal: 101 Minutes per goal contribution: 60
Alexia Putellas dey go for her third Ballon d'Or, and e dey clear why she be strong contender even for di year wey no go according to plan.
Barcelona bin miss out on di Champions League and Spain lose to England for di Euro 2025 final, but Putellas bin still perform well.
She score 16 goals and 11 assists as Barcelona win Spain top flight league and secure domestic treble.
She bin don already win am back-to-back for 2021 and 2022, she be strong contender to win am again.
Claudia Pina (Barcelona)

Wia dis foto come from, Quality Sport Images/Getty Images
Games she play: 27 Minutes she play: 1,557 Goals: 10 Assists: 7 Goal contributions: 17 Minutes per goal: 156 Minutes per goal contribution: 92
She no win di Champions League, but she be di top scorer for di competition. She score 24 goals total for her club and six for Spain.
Di 24-year-old na player wey dey comfortable both as midfielder and forward.
She dey regularly make di difference for club and kontri and Spain miss her for di Euros final. Pina dey among di favourites for di award.
Lucy Bronze (Chelsea)

Wia dis foto come from, Chelsea FC via Getty Images
Games she play: 19 Minutes she play: 1,491 Goals: 2 Assists: 3 Goal contributions: 5 Minutes per goal: 746 Minutes per goal contribution: 298
Lucy Bronze use di pain of a fractured tibia as she win Euro 2025, she also win di Women's Super League, FA Cup and League Cup.
Di full-back win her fourth WSL title as part of di domestic treble for her first season wit Chelsea.
Di 33-year-old play di fourth-highest number of minutes for di Lionesses for di Euros despite her injury, and score di penalty for di quarter-final against Sweden.
Di defender wey lift di trophy no dey play forward, but Bronze bin get spectacular year.
Mariona Caldentey (Arsenal)

Wia dis foto come from, Alex Burstow/Arsenal FC via Getty Images
Games she play: 21 Minutes she play: 1,774 Goals: 9 Assists: 5 Goal contributions: 14 Minutes per goal: 197 Minutes per goal contribution: 127
Mariona Caldentey join Arsenal last summer and help dem deliver di biggest prize for di team history - di Champions League.
She hit di ground running and add creative and cutting edge to di already strong frontline.
She perform well-well since she join di team from Barcelona wia dem bin name her WSL player of di year.
Di Spaniard score for di Euro 2025 final, even though dem lose di final to England..










