You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'I wear my scar wit pride becos na who I be'
'I wear my scar wit pride becos na who I be'
- Author, Monday Idara
- Role, Video Journalist, BBC News Pidgin
Bassy Peace wey pipo sabi as ''Beauty in the scars'' na undergraduate for Kwara State Polytechnic.
Things change for her eight years ago afta she loss a part of her face for one accident.
Peace bin wake up for her house and comot go her work place like every oda day but she no know say she no go return wit her complete face.
Wia she siddon for work electricity wire spark, fall and shock Peace - di accident wey change her life totally.