'I wear my scar wit pride becos na who I be'

Wetin we call dis Video, Peace share bin wake up for her house and comot go her work place like every oda day but little did she know say she no go return wit her complete face.
'I wear my scar wit pride becos na who I be'
Bassey Peace
    • Author, Monday Idara
    • Role, Video Journalist, BBC News Pidgin

Bassy Peace wey pipo sabi as ''Beauty in the scars'' na undergraduate for Kwara State Polytechnic.

Things change for her eight years ago afta she loss a part of her face for one accident.

Peace bin wake up for her house and comot go her work place like every oda day but she no know say she no go return wit her complete face.

Wia she siddon for work electricity wire spark, fall and shock Peace - di accident wey change her life totally.