Champions League quarterfinal: Barcelona, Atletico, PSG and Liverpool play for UCL

Real madrid lost to Bayern and Arsenal beat Sporting on Tuesday

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pundits say PSG and Barcelona be favourites for di first leg of dia quarterfinal games for dia home
Read am in 5 mins

Di first leg of di Champions league quarterfinal games wey happun on Tuesday produce wins for di away teams.

Bayern Munich wey dey form travel to Bernebeu to sama Real Madrid 1-2 wit goals from Luis Diaz and Hary Kane.

Kylian Mbappe score one goal to reduce di deficit to 1-2 afta di German club bin dominate di game wit plenty chances.

Michael Olise wey shine well well for dat game get chance to score but im togeda wit Luis Diaz, Jamala Musiala bin miss dia chances to extend di lead for Bayern.

Olise tink say im gatz get penalty for di last minute when Alvaro Carreras bin push am for ground inside di box but di referee no gree award di penalty.

For Real Madrid, dem gatz blame diaserf as Vinicius bin miss two chances - wey Bayern Munich keeper Manuel Neuer make nine saves for di game to become man of di match.

Di game still dey open ahead of di second leg for Allianz Arena next week.

Bayern are arguably the most in-form team in Europe

Wia dis foto come from, ALVARO MEDRANDA/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Real Madrid go hope to stage comeback for Allianz Arena next week against dia Bavarian opponent

Arsenal beat Sporting for Portugal

Premier league leaders Arsenal struggle wey dem get late goal to take 1-0 advantage comot Portugal to England for di second leg of di quarterfinal.

Sporting CP tink say dem bin get 0-0 draw for di game in front of dia fans, but substitute Kai Havertz bin get oda ideas.

Di German enta di game wey im score in added time afta Gabriel Martinelli bin play one fine pass thru di defence.

Arsenal goalkeeper David Raya wey be di man of di match make five saves to keep Arsenal for di game.

Di gunners kontinu dia unbeaten run for European competition against Sporting (W3 D3) wit dis result.

Di gunners go hope to revenge di time Sporting CP comot dem from two-leg game for Europe for di 2022/23 Europa league R16.

Sporting don win nine out of dia 10 Uefa competition wey be two-legs against English opponent, if dem fit do am again v Arsenal, dat go be 10 out of 11 wins against English opponent, but for di Emirates, na tough game.

Arsenal without Saka and Timber

Wia dis foto come from, DAVID PRICE/via GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Sporting don win nine out of dia 10 Uefa competition wey be two-legs against English opponent.

Barcelona v Atletico Madrid

Dis be one of di two Wednesday games for di quarterfinal first leg.

Dis two teams don already face each oda four times dis season - two times for di Spanish league and two times for di Copa Del Rey.

Atletico bin comot Barcelona to reach di Copa Del Dey final wit Real Sociedad wey Barcelona beat dem two times for di league – one of dem happun ova di weekend.

But Diego Simeone gatz eyes for di UCL na so im rest some of im players (Lookman and Alvarez) ahead dia midweek clash wit Barca.

Atletico gatz di edge for head-to-head – dem bin win di two quarterfinals for 2013/14 and 2015/16.

Barcelona go hope dia home ground wia dem bin win all dia games dis season go help dem; especially as dem already sama Atico 3-0 for di second leg of di Copa Del Rey, even though dem no fit complete di remontada.

Diego Simeone go plan to contain Barcelona and limit dia chances and hope say dem fit create chance to hurt di Barcelona highline and carry advantage to di Metropolitano for di second leg.

Hansi Flick go also expect im team to take dia chances especially as Raphinha, De Jong and Marc Bernal no dey available.

Diego Simeone will hope for a favorable result to carry to the metropolitano

Wia dis foto come from, DIEGO SOUTO/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Barcelona and Atletico already don face each oda four times dis season

PSG v Liverpool

Liverpool beat Galatasaray in the R16

Wia dis foto come from, JULIAN FINNEY/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Liverpool bin win seven of dia last 11 European matches against French teams go hope to get good result for Paris bifor dem return to Anfield.

Anoda coach wey bin dey under pressure na Arne Slot. Di Liverpool manager dey on di verge of trophyless season just one year afta dem win di premier league.

Dem dey fifth for di league table wey dem comot all di domestic cup competition.

Dia only hope for trophy na di UCL.

But dem first gatz to face PSG – di defending champions.

Di two teams already bin meet each oda for di R16 last season when PSG win for penalties on dia way to win di trophy.

Liverpool bin win seven of dia last 11 European matches against French teams go hope to get good result for Paris bifor dem return to Anfield.

Liverpool don win six of dia last eight UCL quarterfinal games.

PSG don win dia last four two-leg games against English clubs; dem sama Chelsea dis season, sama Liverpool last season for R16 wey dem also comot Aston Villa for di quarterfinals and Arsenal for di semifinals.

Tuesday results

  • Real Madrid 1-2 Bayern Munich
  • Sporting CP 0-1 Arsenal

Wednesday fixtures

  • PSG v Liverpool - 7 PM GMT (8 PM WAT)
  • Barcelona v Atletico Madrid - 7 PM GMT (8 PM WAT)