You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Museum display 200-year-old condom wit clear print
- Author, Barbara Tasch
- Role, BBC News
- Read am in 3 mins
Dem don display one close to 200-year-old condom for di Rijksmuseum for Amsterdam.
Sabi pipo say na from one sheep body dem take make an and e feature one unique print wey represent one nun and three clergymen.
Di rare artefact date back to 1830 and di museum buy am for one auction last year. Di condom na part of one exhibition on di 19th Century prostitution and sexuality.
Prints, drawings and photographs also form part of di display.
Na "one subject wey dey underrepresented for our collection," di museum tok for one press release.
Rare artefacts na somtin wey dey totori collectors sake of di history wey dey attached to dem and di years dem produce dem.
One handbag wey dem make from alligator skin and tiny bottles of perfume wey still dey release strong scent, na just some of di precious artefacts dem recover from di world most famous shipwreck – di Titanic.
Di exact location of di warehouse wia dem dey store dis tins na closely guarded secret, becos of di value of dia contents. All we fit say na say e dey somwia for Atlanta, Georgia, for United States.
Inside, thousands of items dey inside di shelves: from one bathtub and dented porthole, to finely designed glassware and tiny buttons.
Dem give BBC rare chance to look around di storage facility and discover di tori behind some of dis objects.
"E symbolise both di lighter and darker sides of sexual health, for time wen di quest for sensual pleasure dey tensed wit fears of unwanted pregnancy and sexually transmitted diseases – especially syphilis," di museum add.
Di museum explain say di belief wey dey ground na say di condom na souvenir from one brothel and na only two of such objects survive to dis present day.
Di obvious print on dis specific object show one nun wey sidon in front of di three men, her dress dey up and her legs dey apart, she point her finger at di clergymen, all of dem stand in front of her holding up dia habits.
Di condom also carry di inscription "Voilà mon choix", wey mean "Na my choice be dat".
Di museum say dem consider wetin dem write as a "parody of both celibacy plus di Judgement of Paris from Greek mythology", di first one na di mythological story of one Trojan Prince wey im name na Paris wey gatz decide who be di fairest goddess among Aphrodite, Hera and Athena.
Di Dutch museum note say dia Print Room collection hold some 750,000 prints, drawings and photographs but say dis na di first example for di collection of a print on a condom.
Dem go display di condom until di end of November.