Outing service hold for Herbert Wigwe, im wife and son afta funeral rites wey last for one week

Herbert Wigwe burial

Wia dis foto come from, RVGH Press

Dem don hold outing service for di late Herbert Wigwe, im wife Chizoba and pikin Chizi afta dem bin bury dem for dia hometown of Omueke, Isiokpo, for Ikwerre local goment area of Rivers State.

Di service bin hold on Sunday for di Redeemed Christian Church of God, Lion of Judah Parish for di area.

Dis service hold one day afta dem bin bury di late CEO of Access Holdings Plc im wife and im son dem wey die for helicopter crash for United States.

Pipo wey bin show for di burial include Senate President Godswill Akpabio; FCT Minister, Nyesom Wike; business leader Aliko Dangote, HRH Muhammadu Sanusi II, Gov. Alex Otti, Gov. Dapo Abiodun, former Senate President Bukola Saraki; Gov. Babajide Sawno-Olu, former Anambra State Gov. Peter Obi, Rotimi Chibuike Amaechi.

Odas na Rivers State Govnor Siminalayi Fubara and State Commissioner of Police wey bin also act as di Chief Security Officer for di burial.

Combined funeral service for di Wigwes

Dem bin hold combined funeral service for di late bank chief, im wife and im son for RCCG Tribe of Judah Parish for Isiokpo, Ikwerre local goment area of Rivers State.

On Friday 8 March, Govnor of Rivers State, Siminalayi Fubara di Christian wake-keeping and commendation service of di deceased wit govnors of Lagos and Ogun States, Babajide Sanwolu and Chief Dapo Abiodun, Minister of Trade, Chief Wale Edun, FCT Minister, Chief Nyesom Wike, Mr. Peter Obi, former govnors of Ekiti and Delta, Kayode Fayemi and James Ibori.

Ogbonge businessman Aliko Dangote dey among distinguished Nigerians wey attend di Christian wake-keeping and commendation service for Isiokpo.

Herbert Wigwe burial

Wia dis foto come from, RVGH Press

Herbert Wigwe burial

Wia dis foto come from, RVGH Press

Wetin we call dis foto, Children of late Herbert Wigwe: R-L -Tochi, David and Hannah Wigwe
Herbert Wigwe burial

Wia dis foto come from, RVGH Press

"Make your life make impact” - Govnor Fubara

Herbert Wigwe burial

Wia dis foto come from, RVGH Press

For di funeral service, Govnor Siminialayi Fubara of Rivers State tell pipo say make dem ensure say dia life make impact.

Govnor Fubara tok say late Wigwe don finish di work e come do for di world and add say wetin remain na for pipo to do dia own.

E assure say di state goment go try to work wit di Wigwe Foundation to immortalise di legacy of di bank chief and ensure im dream for di Wigwe University come true.

Dignitaries wey attend di funeral service include Senate President Godswill Akpabio, govnors of Bayelsa and Akwa Ibom States Sen. Douye Diri and Pastor Eno Umo, former CBN govnor Emir Sanusi Lamido Sanusi, Aliko Dangote, Peter Obi, Aminu Tambuwal among many odas.

On im part, Senate President Godswill Akpabio wey represent President Bola Tinubu say di death of Wigwe no be only big loss to di business community but na also great loss to Nigeria as kontri and e go continue to mourn am even afta di burial.

E extend di condolences of di federal goment to Wigwe papa and mama as well as di immediate family and encourage dem to keep up di good legacy of dia son and father.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Herbert Wigwe burial

Wia dis foto come from, RVGH Press

Wigwe Burial

Wia dis foto come from, RVGH Press

Herbert Wigwe burial

Wia dis foto come from, RVGH Press

Wetin we call dis foto, Rivers State Govnor Siminialayi Fubara dey among many dignitaries wey attend di commendation service
Pipo for so Commendation service

Wia dis foto come from, RVGH Press

Wetin we call dis foto, Di combined funeral service for Herbert Wigwe, im wife Chizoba and son Chizi begin wit a commendation service for dia home town Isiokpo, Ikwerre LGA, Rivers State
Sim Fubara, Sanwo Olu and odas

Wia dis foto come from, RVGH Press

Wetin we call dis foto, Govnors of Rivers, Lagos and Ogun States for di commendation service
Commendation service

Wia dis foto come from, RVGH Press

Wetin we call dis foto, Captains of Industry also attend di commendation service
Pipo for di service

Wia dis foto come from, RVGH Press

Wetin we call dis foto, Di commendation service hold on Friday 9 March for Isiokpo
Herbert Wigwe burial

Wia dis foto come from, RVGH Press

Wetin we call dis foto, Na di Redeemed Christian Church of God RCCG conduct di service

Na di Redeemed Christian Church of God conduct di commendation service wey gada many political stalwarts, captains of industry and sympathisers from across di kontri.

Pastor in charge of Region 33, South-South, Pastor David Adeoye, advise pipo to do good to humanity with whatever position dem occupy and add say di commendation service for Herbert Wigwe na opportunity for dem to reflect on di lifetime legacies di late bank chief leave behind, not just for di industry but to all shades of humanity.

Herbert Wigwe burial

Wia dis foto come from, RVGH Press

Commendation service

Wia dis foto come from, RVGH Press