'Some deadi body fit dey Cameroon' – Minister update on Rivers helicopter crash on top Atlantic Ocean

Read am in 3 mins

Di Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo don tok say dem recova one of di bodies of pipo wey dey involved for di Rivers helicopter crash.

Dis new informate dey come afta families of victims of di helicopter crash for di Atlantic Ocean for Bonny, Rivers State, southern Nigeria demand recovery of di body of dia pipo.

Rememba say di accident happun on 24 October, 2024, for Atlantic Ocean near Bonny Finima wey involve eight pesins onboard.

Out of di six passengers and two crew members, authorities bin confam di recovery of three bodies while search still dey on for di odas dat time.

According to Keyamo, dem recova di flight recorder from di helicopter on Friday 8 November.

E add say say search still dey go on to find di deadi body of passengers and crew members wey still dey miss.

Meanwhile, one of di deadi body don reach Cameroon wia di water don carry am reach.

"Cameroon don dey notified to look out for bodies for dia waters, dis na becos di crash happpun around Cameroon and we find one of di bodies near Cameroon," Keyamo tok.

Di minister add say dem still dey do search for di remaining two crew members and one passenger wey remain.

Meanwhile, family of Ledum Boris Ndobor wey bin dey on board di helicopter dey ask for im bodi.

Ledum Boris Ndobor from Khana local goment area of Rivers na di NUPENG branch chairman of OML 123 oil field wey NNPCL bin dey operate bifor im death.

oda families too still dey wait make dem find di bodi of dia loved ones wey go missing afta di crash.

'Coordinated search still dey on' - NSIB

Di Nigerian Safety Investigation Bureau (NSIB) still dey continue di coordinated recovery operation and investigation into di Sikorsky SK76 helicopter ditching incident wey involve a helicopter wit registration 5N BQG, operated by Eastwind Aviation.

Dem say survey operations don commence and divers enta di water to begin underwater search and recovery efforts.

Di statement say dem send a helicopter to retrieve di fourth recovered body, wey dem transport to a designated facility.

Di NSIB team wey dey supported by di joint Search and Rescue team say dem go continue to sweep di search areas and intensify recovery efforts as dem dey dedicated to di recovery effort and to gada crucial evidence from di scene.

E say despite challenging environmental conditions, di Bureau still dey committed to complete a thorough and respectful recovery operation.

Na 1998 dem manufacture di helicopter for US and France na im do di engines of di helicopter.

Oga Festus Keyamo tell tori pipo for Abuja say di US states don give dem one ogbonge investigator wey go chook eye for di helicopter crash.

France wey manufacture di engines too don also give dem one accessor wey go chook eye for di engines.

"We go publish di report for di NSIB website in 30 days" Dis na to avoid di kain situation make e no happun again.

Meanwhile di NSIB also dey in charge to give support to di families of di pipo wey die.