Astronauts Butch and Suni don finally return back to Earth

Astronauts Butch and Suni don finally return back to Earth

Suni Williams smile as she comot di capsule for inside one white space suit and helmet, two assistants wey wear black dress help her

Wia dis foto come from, NASA

Afta nine months for space, Nasa astronauts Butch Wilmore and Suni Williams don finally return back to Earth.

Dia SpaceX capsule bin make one fast and fiery re-entry through di Earth atmosphere, bifor dem use four parachutes carry dem land for off di coast of Florida.

"Di crew dey okay," Steve Stich, manager, Nasa Commercial Crew Program, tok for one news conference.

Dia arrival don bring an end to one mission wey suppose last for only eight days.

Dia journey go space bin extend afta di spacecraft Butch and Suni bin use travel go di International Space Station suffer plenty technical problems.

"E dey awesome to have crew 9 home, dia landing dey beautiful " said Joel Montalbano, deputy associate administrator, Nasa Space Operations Mission Directorate tok.

E thank di astronauts for dia resilience and flexibility, e say SpaceX be "great partner".

Di journey home take about 17 hours.

Dem put di astronauts on top one stretcher, wey be di standard practice afta dem don spend so many months for di weightless environment.

One medical team go check dem bifor dem go fit reunite wit dia families.

How di NASA astronauts wey hook nine months for space take come back
Nasa astronauts Butch Wilmore and Suni Williams dey onboard di international space station dey smile as dem pose for di orbiting lab. Butch dey look out from inside one white circular hatch, while Suni dey lie just outside di hatch.

Wia dis foto come from, NASA

Wetin we call dis foto, Butch Wilmore and Suni Williams don dey on di ISS since June 2024
Read am in 7 mins

Dia stay on di International Space Station (ISS) suppose last for only eight days, but dia mission extend dramatically afta di spacecraft wey carry dem go di space suffer several technical problems.

Di two of bin travel back come to di Earth inside one SpaceX capsule alongside Nasa astronaut Nick Hague and Russian cosmonaut Aleksandr Gorbunov.

Dem comot di ISS at 05:05 GMT (01:05 EDT) on Tuesday and dey expected to arrive off di coast of Florida later di same day, at 21:57 GMT (17:57 EDT).

Dia landing time, however, fit change if di weather conditions no dey good enough.

E go mark di end of one mission wey grab di attention of di world, however di final stages of dia journey no go dey easy.

Di SpaceX Dragon capsule go make one fast re-entry through di Earth atmosphere, and e go endure temperatures of up to 1600C.

As e slow down fast-fasr, di astronauts go experience significant g-forces, about four times di Earth gravity.

Finally, four large parachutes go open, wey go allow di craft to land gently for di ocean.

How Nasa Suni and Butch take fill nine months in space?

Four astronauts on di International Space Station wey wear mix of Santa hats and reindeer antlers gada togeda for front of camera to wish pipo merry Christmas

Wia dis foto come from, NASA

Wetin we call dis foto, Di crew aboard di International Space Station send Christmas greetings last year and enjoy a space-food festive "feast"

Di tori of Butch and Suni start for June 2024.

Dem bin dey take part for di first crewed test flight of di Starliner spacecraft, wey aerospace company Boeing develop.

But di capsule suffer several technical problems during di journey go di space station, and dem tok say e too dey risky to bring di astronauts back di earth.

However, as dem dey hook for space, dis na how life take be for di NASA astronauts wey circle 250 miles (400km) above us, and how dem pass di time.

Voting, enjoying Christmas dinner and keeping fit in zero gravity – na just some of di tins wey Butch Wilmore and Suni Williams do to keep themselves busy during dia prolonged stay on di International Space Station (ISS).

Plenty serious space stuff bin dey to keep dem occupy.

59-year-old Suni, and 62-year-old Butch, 62 dey help ongoing missions for di station wit maintenance and experiments, and dem don carry out spacewalks.

Suni go outside for mid-January wit fellow astronaut Nick Hague to perform repairs on di craft. She and Butch bin go out togeda later in di month.

Dia work bin include repairing equipment wey govern station orientation, adding light filters on di NICER X-ray telescope, and replacing one reflector device on one international docking adapter.

Thinking about planet Earth

Butch and Suni accept di challenge wey life throw at dem. For one news conference for September, dem tok say dem dey trained to "expect di unexpected".

Dem get opportunities for reflection about life back home - and for watching a lot of sunrises and sunsets.

As di space station make 16 orbits of Earth every 24 hours, e dey travel through 16 sunrises and sunsets, as e don treat those on board to a sunrise or sunset every 45 minutes.

Living wit dat kain unique view of di Earth dey give plenty of room to observe am, Suni tok.

"E dey open one door wey go make you tink a bit differently. Na one planet we get and we suppose dey take care of am," she tok.

"So many pipo on Earth dey send us messages wey make us feel right at home wit everybody."

Voting for di president from space

Butch and Suni and di oda two Americans wey dey on board wit dem, Don Pettit and Nick Hague, each bin get di opportunity to vote for last year US election.

"Na very important duty we get as citizens," Suni tell tori pipo.

Butch tok say Nasa bin make am "very easy" for dem to dey included for di elections.

To facilitate dia voting, the Mission Control Center for Houston bin send ballot papers through encrypted email to di ISS.

Di astronauts fill dem and transmit dem to satellites wey relay dem to one ground terminal for New Mexico.

From dia, landlines transmit di ballots go Mission Control, wey electronically send dem go di astronauts dia county clerks for filing.

Keeping fit in zero gravity

Woman in navy shorts and top dey run on one treadmill

Wia dis foto come from, NASA

Wetin we call dis foto, Suni Williams dey exercise on one treadmill for one previous ISS mission for 2012

Butch day dey start at 04:30, and Suni day dey start around 06:30.

Both of dem dey enjoy di two hours or more of exercise dem must do everyday to fight di loss of bone density from living in space.

"Your joints no go pain you, and e dey quite nice," Butch tok.

Three different machines dey help counter di effect of living in zero gravity.

Dem dey use di Advanced Resistive Exercise Device (ARED) for squats, deadlifts, and rows wey dey work all di muscle groups.

For treadmills, crews must strap am in so dat dem no go float away, one cycle of ergometer also dey for endurance training.

Letting your hair... up, at Christmas

During Christmas, di astronauts on top di International Space Station bin post one festive message wia dem take wish dia friends and family on Earth merry Christmas.

Di team bin wear Santa hats and reindeer antlers, dem throw di slowly gyrating microphone give each oda to speak as candy canes float around dia heads.

Na chance for di crew to flex and relax dia mind, though for Suni case, e dey more like a case of letting it 'up'. Zero gravity give her one hairstyle wey go need plenty products to achieve on Earth.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

One of Butch and Suni final duties on board di ISS na to make pipo wey go replace dem feel welcome.

On 16 March, one SpaceX capsule wey carry new crew land di ISS. Na one deeply significant event for Butch and Suni, as e make way for dem to come home.

Capturing di excitement, Don Pettit, wey go remain on di ISS, bin post dis video dem take through di window as e dey approach and dey park.

Butch bin ring one ceremonial bell as Suni hand ova command give cosmonaut Alexei Ovchinin.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Wetin go happun now wey di astronauts don land for di earth?

As di astronauts land earth, dem carry dem go di Johnson Space Centre for Houston, Texas, where medical experts go check dem.

Long duration missions for space dey get as e be for body, as astronauts dey lose bone density and suffer muscle loss. E dey also affect dia blood circulation, and fluid shifts fit also affect dia eyesight.

E fit take long time for di body to return to normal, so dem go give di two of dem extensive exercise regime make dia bodies fit re-adapt to living wit gravity.

But di first priority for Butch and Suni go be to see dia families, friends - and pets.

Garrett Reisman bin dey in touch wit her friend Suni while she dey for space.

"I bin get one email from Suni just di oda day and she tok say she miss sitting for di front of her house for Maine wit di dogs, and smelling di fresh air, feeling di sun on your face," e tell BBC.

"Na di basic tins about life here on Earth you miss."