Samia win Tanzania election wit 98% of votes, as hundreds die sake of protests

- Author, Wycliffe Muia
- Read am in 4 mins
President Samia Suluhu Hassan don win Tanzania presidential election, di electoral commission declare.
Samia secure anoda term in office despite all di protest wey dey happun for di kontri.
According to di electoral commission, Samia win 98% of di votes, nearly sweeping di 32 million ballots cast for di election wey happun on Wednesday.
International observers don express concern over di lack of transparency and widespread kasala wey don lead to di death of hundreds of pipo and many odas wey wunjure.
Di nationwide internet shutdown dey make am hard to verify di death toll.
Di govment don play down di level of di violence - and authorities don extend di curfew in dia effort to stop di violence.

"I hereby announce Samia Suluhu Hassan as di winner of di presidential election under di Chama Cha Mapinduzi (CCM) party," Jacobs Mwambegele, di electoral chief, tok as e dey announce di results on Saturday morning.
Samia secure about 31.9 million votes, or 97.66% of di total, wit turnout nearing 87% of di kontri 37.6 million registered voters, di electoral chief tok.
For Tanzania semi-autonomous archipelago of Zanzibar - wey elect dia own govment and leader - CCM Hussein Mwinyi, wey be di incumbent president, win wit nearly 80% of di vote.
Di opposition for Zanzibar say "massive fraud" dey, di AP news agency report.
Mwinyi swearing-in ceremony dey happun for Amaan Complex stadium for Zanzibar.

Wia dis foto come from, Photothek via Getty Images)
Protests kontinu on Friday, as demonstrators for di port city of Dar es Salaam and oda cities enta streets, dey tear down Samia posters and attack police and polling stations despite warnings from di army chief to end di protest.
Tori of protests no dey as at Saturday morning, but tension remain high for Dar es Salaam streets, wia security forces mount roadblocks across di city.
Na mostly young pipo dey lead di protests, wey don tok say ojoro dey di election.
Dem accuse di govment say dem no follow democracy becos dem suppress di main opposition leaders - one dey jail and dem comot di oda one on technical grounds.
Toktok pesin from di opposition Chadema party on Friday tell AFP news agency say "around 700" na im don die in clashes wit security forces, while one diplomatic source for Tanzania tell di BBC say credible evidence dey say at least 500 pipo don die.
Foreign Minister Mahmoud Kombo Thabit don describe di violence as a "small set of kasala hia and dia" and say "security forces act very swiftly and decisively to address di situation".
Na two main opposition contenders - Tundu Lissu, wey dey jail ontop treason charges, wey e don deny, and Luhaga Mpina of di ACT-Wazalendo party - but dem comot am ontop legal technicalities.
Na sixteen oda small parties, wey none of dem don get any history of better public support, na im dem allow to run.
Samia ruling party, CCM, don dominate di kontri politics and neva election since independence.
Ahead of di election, rights groups condemn govment suppression, wit Amnesty International wey tok say a "wave of terror" wey involve enforced disappearances, torture, and extrajudicial killings of opposition figures happun.
Di govment reject claims, and officials say di election go dey free and fair.
Samia come into office in 2021 as Tanzania first female president sake of di death of President John Magufuli.












