You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
How Nigerian govnors dey tackle effect of rising cost of living for dia states
Some state goments don begin take actions to address di serious hunger plus di rising cost of living for dia various regions.
Dem take dis steps as Nigerians dey lament di high cost of food items across di kontri.
For some parts of di kontri, pipo don begin enta streets to protest di continuous rise in food prices for Africa biggest economy.
Recently, thousands of Nigerians enta streets for di northern states of Niger, Kano and Kogi and Oyo for western Nigeria, to demand urgent interventions wey go address di rising cost of living as dem claim say di situation don become unbearable.
Price of food items dey increase for dia fastest rate in nearly 30 years. Official record from di Nigeria National Bureau of Statistics (NBS) report say inflation dey at 29.9%, di highest in almost three decades, and food inflation tanda for 35.4%.
Many pipo all ova di world dey feel di heat of di high cost of living and pressure of inflation but di mata worse for Nigeria, sake of di fuel subsidy goment remove plus di persistent weakening of di naira, di kontri local currency, against major foreign currencies.
To address di situation, President Bola Tinubu bin meet wit di 36 govnors of di federation and charge dem to tackle di economy pressure dia citizens dey face.
Nigeria Senate President Godswill Akpabio oda lawmakers bin discuss di mata of di high cost of living for di Upper Chamber and as dem dey try find solutions tok say one “unverified report” show say state govnors receive N30 billion each from di Federation Account to cushion inflation plus di high cost of food for dia respective states.
End of Di one wey oda users dey read well well
Last September, di federal goment tok say dem don release N2 billion give govnors out of di N5 billion loan dem offer to each state as palliative to cushion di effect of di fuel subsidy removal.
During di plenary on Tuesday, 20 February, Oga Akpabio tok say information wey dey available to am indicate say apart from di first tranche of funds govnors collect, dem don receive additional N30 billion through di Federal Inland Revenue Service (FIRS).
“I gatz say unverified report get am say each of di state goments in di last few months don receive additional N30 billion from Federal Inland Revenue Service outside dia normal allocations from di Federation Account to assist dem to reduce di food situation,” e tok.
Di senate president advise di govnors to use di moni well-well to reduce di high cost of food items plus oda challenges di kontri dey face.
Some states don begin take action. But wetin dem dey do?
Lagos state slash cost of transportation, to feed ova 1000 residents
Lagos goment tok say dem don begin work to identify food vendors across di state wia at least 1000 residents for di 20 local goment go get access to one free meal per day.
Govnor Babajide Sanwo-Olu announce dis mitigating effort on Thursday.
E say di move na part of di state goment efforts to ease di current economic hardship for di kontri.
Govnor Sanwo-Olu also list oda measures to ease economic pressure wey include; reducing di number of times civil servants for di state go dey physically present for work. E also announce 25% reduction on all public transportation for di state.
Sanwo-Olu say, “Di first tin we go do going forward na to start wit our own public servants to create flexible working hours for dem.
“So, immediately from next week, we go work out a plan wia civil servants from Level 1 to 14 go come office maximum three times a week.
“Level 15 to 17 go come work four times, all civil servants go work remotely anytime dem no dey work from office."
To address di rising food prices, di govnor say dem go open Sunday Markets across 42 identified markets across di state to sell food items at really affordable rates.
"Lagosians go fit buy commodities, wey no go dey above di N25,000 threshold. We dey aim to serve ova 500,000 Lagosians wit essential food items at rates wey low pass di inflation rate". Govnor Sanwo-Olu add.
Ogun State - Provision of staple food items to citizens
Di Ogun state goment tok say dem don decide to provide essential food items such as rice, garri, and beans for dia citizens.
Di state govnor, Dapo Abiodun for one tweet e post on X tok say im don arrange about 100 trailers of rice wey go begin deliver di food items immediately.
E add say to ensure fair distribution, elderly pipo and dose wey dey vulnerable go get rice free of charge, while odas go buy am at di original price e be before dollar begin rise.
On di mata of di N5 billion naira federal goment give dem to address di current economic difficulties, e say "our administration don implement one 5-billion-naira intervention plan".
Kwara goment continue fresh distribution of N2bn worth of rice
Kwara State goment tok say dem don begin di distribution of anoda 20,000 bags of 10Kg rice palliatives give pipo for di state.
Di Office of di Senior Special Assistant on Community Development, Lawal Olohungbebe wey dey coordinate di distribution tok say dem distribute di rice palliative give pipo wey need am most for different communities for dis new phase.
Oga Olohungbebe tok say efforts dey on to reach oda segments of di society through di clerics, community leaders plus oda stakeholders across di 16 LGAs for Kwara.
E add say goment bin earlier distribute 10,000 bags of 10kg rice palliatives give di Nigerian Labour Congress (NLC) and Trade Union Congress (TUC) to distribute give dia members.
Akwa Ibom enact bill to regulate price of food items
Akwa Ibom State Govnor, Umo Eno, tok say im don sponsor one bill wey dey before di State House of Assembly to tackle di cost of living crisis im pipo dey go through.
E say di Bill for di establishment of di State Bulk Purchasing Agency, na to ensure say pipo go fit afford di price of staple food items.
“We go buy di food items in bulk and ensure say e dey available to our pipo for relatively lower prices. Di process go dey transparent," Govnor Eno tok for tweet e post on X.
Benue State - Provision of fertilisers
Benue State govnor, Fr. Hyacinth Alia on im part tok say im administration don provide fertilisers for farmers to grow food.
E add say im also pay for di external examinations fees of candidates wey go sit for di National Examinations Council (NECO) and di West African Examination Council (WAEC) as way to reduce di hardship pipo dey face.
Di govnor promise to always make di welfare of di pipo im priority.
Borno State distribute N225m in cash and food items to 70,000 families for Bama
Borno govnor, Babagana Umara Zulum, tok say im don distribute N225m in cash and food items give ova 70,000 vulnerable families for Bama local goment area of di state.
Di govnor give dis informate inside statement.
"On Sunday, ova 45,000 females receive N5000 in cash and one wrapper each, while about 25,000 male heads of households receive food items on Monday.
"Each male beneficiary receive one bag of rice and one bag of maize grain," di statement tok.
Zulum explain say dem prioritise di distribution of food and cash to communities wey dey affected by insurgents and residents wey dey struggle to meet dia livelihood, make dem for no recruit dem to join insurgent groups.