EFCC tok why dem arrest Verydarkman [VDM]

Wia dis foto come from, VDM Facebook
- Author, Gift Andrew
- Role, Reporter
- Reporting from, Lagos
- Read am in 5 mins
Nigeria financial crimes police EFCC don confam say na dem hold popular rights activist Martins Vincent Otse alias Verydarkblackman (VDM).
Di EFCC confam di arrest of VDM to BBC News Pidgin.
Tok tok pesin of di commission Dele Oyewale on Monday say dem arrest di activist based on petitions by some complainants wey get grievances against VDM.
"We arrest am to respond to series of allegations raised against am by some petitioners" na so Oyewale tok.
Wen we ask am weda di petition dey related to GT Bank, e say di petition na from different pipo and dem owe di petitioners duty to protect dem.
He add say "we go release am wen e meet di bail conditions and we go carry di case go court as soon as possible, we dey law abiding".
E confam say na for Abuja dem arrest di activist.
How di tori comot

Wia dis foto come from, VDM Facebook
Tori bin comot for social media on Friday say VDM bin dey miss, odas tok say EFCC arrest am inside GT Bank. Im supporters begin online protests, some announce say dem go move against di bank.
As at press time, GTBank never issue any statement to dat effect.
For online video wey BBC see for di activist Facebook page, some mentees and supporters of VDM go EFCC office to give di activist food over di weekend, but dem come back say di security officers say nobody dey allowed to go see am or to give am food, say di officers go give am food by dia sef.
Some young pipo tok say dem go do physical protest for Abuja on Monday.
Many Nigerians don enter social media to call for di release of di activist.
Presidential candidate of di Labour Party for Nigeria last elections Peter Obi and popular singer David Adeleke alias Davido follow chook mouth for VDM matter
While Davido dey call for im release, Obi dey condemn di manner dem take arrest di activist say dem arrest am like wia dem dey kidnap pesin.
Activist Omoyele Sowore allege say EFCC arrest VDM to silence am as im be one of di outspoken pipo for di kontri wey dey challenge corruption.
Wetin VDM lawyer tok
Meanwhile lawyer to VDM Mr Deji Adeyanju say na EFCC arrest di activist but dem no happy how di arrest happun.
For statement from di lawyer law firm, dem claim say na for bank premises EFCC officials arrest VDM afta di activist and im mama go do complaint inside di bank.
According to dem di officers lock up VDM for dia Abuja office and wen dem go to see him, di officers say e refuse to see anybody.
Dem also claim say EFCC officials show dem di arrest warrant wey one chief Magistrate Njideka Iloanya Duru sign for di arrest of Martins Otse ontop allegation of cyberstalking.
Di firm say dem go follow up di matter to activate im release, say dem no happy say EFCC no gree tell dem his exact offense.
Who be VDM?

Wia dis foto come from, VDM Facebook
Activist Verydarkblackman na sef acclaimed philanthropist, wey dey controversial for di Nigeria social media space.
Im dey known for confronting goment officials, corruption and pipo wey dey go against di law.
Sake of im activism, im don chop arrest plenti times and get pending court cases for many Nigeria courts.
Actor Rita Edochie enter social media write say VDM dey always stand for di truth.
Oda times VDM chop arrest
Dis no be di only time VDM dey chop arrest from security agencies for Nigeria sake of various controversial issues wey im dey involved in.
For March 2025 Chief Magistrate Court for Abuja issue a warrant of arrest against VDM as e fail to appear bifor di court on top accuse of criminal defamation wey popular gospel musician Mercy Chinwo sama am.
Di matter dey bifor Chief Magistrate Emmanuel Iyanna of di FCT Chief Magistrate Court, who on March 6, 2025, bin summon VDM to appear bifor am to defend imsef. tho di arrest no happun dat time, e no dey clear weda na di matter lead to dis recent arrest.
For October 2024, police bin detain VDM after im go honor dia invitation for police station. Tori be say dem detain am for allegedly wearing police uniform to use produce social media content wen him no be police officer. Dem later release am on bail.
For February 2025, VDM call out EFCC say dem wan arrest am based on video wey show wia im dey spray money.
E say dem bin don dey plan to arrest since sake of how im dey talk about dia oga pata pata but dem no get real evidence to hold am down until dat video surface.










