You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wia be Syria, who be di rebels wey take control of am and wetin go happen next?
Di leader of di Islamist militant group, Hayat Tahrir al-Sham (HTS) Abu Mohammed al-Jawlani don dey stamp imself as di figurehead for di future of Syria afta President Bashar al-Assad.
Russia don confirm say dem don give al-Assad assylum for Moscow.
Abu Mohammed al-Jawlani and im group launch one ogbonge surprise attack from dia powerbase for di north-western province of Idlb, enta di cities of Aleppo, Hama and Homs, and di result na wetin dey happen for Syria right now.
Oda rebel groups also follow join bodi and na bicos of di sense of say di whole of Syria don turn against di regime, wey make am collapse sharp-sharp.
Among dis oda groups, some wey don enta Damascus, na rebel factions wey bin dey work once under di umbrella of di Free Syrian Army. Dem bin dey operate from di southern towns and cities wey don dey dormant for years.
For di east, Kurdish-led forces bin benefit from di collapse of di Syrian army to take control of di main city, Deir El-Zour, for di Syrian desert. And for di far north by di Turkish border, di Syrian National Army wey dey backed by Ankara fit be anoda ogbonge player to wetin go happun next.
Al-Jawlani don dey ginger for years to change how pipo dey see im organisation from one wey pipo dey fear sake of dia ideological zeal to one wey Syrians fit see as beta choice to di Assad regime.
Wen dem start HTS for 2011, e bin get different name, Jabhat al-Nusra and dem bin dey as direct branch of al-Qaeda.
Di leader of di self styled Islamic State group Abu Bakr al-Baghdadi bin also get hand for di formation of di group.
Pipo bin dey see am as one of di deadly and most effective groups wey bin dey fight against President Assad.
Di group dey proscribed as terrorist group by di UN, US, Turkey and oda kontris even till now.
But al-Jawlani bin publicly break up wit al-Qaeda, scata Jabhat al-Nusra and arrange new organisation wey go with di name Hayat Tahrir al-Sham (HTS) afta dem start to collabo wit plenti oda groups like dem a year later.
Doubts bin dey dat time and even till now ova weda HTS still get ties to al-Qaeda. But in di past week and half, dia message na about inclusiveness and rejection of violence or revenge.
Di group don enta deadly fights wit oda rebel and opposition groups, e fit happun again.
Di end of President Assad rule no really change how tins be in terms of di divisions inside Syria. Dis na di place wia different groups don hold various territories wey no dey di goment control.
Efforts by HTS to get legitimacy don scata bicos of accused human rights abuses.
Map: Where Syria dey?
Syria na country with a population of about 22 million people, e dey located on di east coast of di Mediterranean sea. E dey share border with Turkey to di north, Lebanon and Israel to di west and southwest, Iraq to di east and Jordan to di south.
Who be Abu Mohammed al-Jawlani?
Syrian rebel leader Abu Mohammed al-Jawlani don drop di name wey pipo take know am as a jihadist fighter and e don dey use im real name, Ahmed al-Sharaa, for official communiques since Thursday, ahead of di fall of President Bashar al-Assad.
Dis move na part of im effort to create legitimacy, as im Islamist militant group, Hayat Tahrir al-Sham (HTS) and oda rebel factions don announce di capture of di Syrian capital, Damascus.
But who be Jawlani - or Ahmed al-Sharaa?
Inside one interview for 2021, Jawlani tok say dem born am in 1982 for Saudi Arabia wia im papa bin dey work as oil engineer until 1989.
Dat year, di Jawlani family return to Syria wia e grow up and live for di Mezzeh neighbourhood of Damascus.
Im journey as a jihadist begin for Iraq, linked to al-Qaeda and later, di Islamic State of Iraq (ISI).
Afta di 2003 US-led invasion, Jawalni join oda foreign fighters for Iraq and in 2005, dem capture am and put am for prison for Camp Bucca.
Na for prison e solidify im jihadist connect and later on, e meet wit Abu Bakr al-Baghdadi, di quiet scholar wey later become di leader of IS.
For 2011, Baghdadi bin send Jawlani to Syria wit funding to establish al-Nusra Front, one undercover faction wey dey tied to ISI.
By 2012, Nusra don become ogbonge fighting force for Syria, but dem bin hide dia IS and al-Qaeda ties.
Wahala start for 2013 wen Baghdadi group for Iraq bin tok say ISI and Nusra don join body, declaring di creation of di Islamic State of Iraq and di Levant (ISIL or ISIS), and revealing for di first time di links between dem.
Jawlani no like am, bicos e no want im group to dey associated wit ISI violent tactics, so e resist di move and di group break.
To comot from dat tricky situation, Jawlani come pledge allegiance to al-Qaeda, and al-Nusra Front come become dia branch for Syria.
In 2016, Jawlani cut ties wit al-Qaeda. E rename di group as Jabhat Fatah al-Sham and later as Hayat Tahrir al-Sham (HTS) for 2017.
But even though HTS don break from al-Qaeda and change name, Western powers consider di break-up as fake.
Di group na still a terrorist organisation according to di UN, US, UK and oda kontris, and di US still put a $10m reward for information wey go lead to Jawlani arrest.
Wetin go happen next for Syria?
How Syria immediate political future go develop go depend on wetin di organisation wan do and wetin dem fit do.
E go also depend on di claims and pressures from oda groups, plus di role wey oda major outside powers wey don get mouth for di kontri recent history go play.
Dem include Iran and Russia wey support President Assad, Turkey wey dey back di rebel groups, plus including di US wey still get military presence for di Kurdish held east of di kontri.
Dem dey play catch up now and dey try set new strategic course wey go serve dia interests afta di downfall of di Assad dynasty.
Di United Nations Security Council go hold emergency meeting later today to discuss di fall of Bashar al-Assad's regime.
Na Russiarequest di meeting after reports ccome out say dem don offer asylum to Assad and im family for Moscow.