Ogbonge fotos of Easter celebrations from around di world

Plenti ceremonies dey take place across di world to mark di most important festival for Christian calendar - Easter.

Jesus resurrect on Easter Sunday, na so Bible tok, days afta im die on di cross on Good Friday.

Na tradition for many pipo to go church on Friday, Saturday and Sunday.

Here for Nigeria, President Bola Tinubu wish im kontri pipo Happy Easter.

Bifor we share di fine Easter celebration pictures, see President Tinubu Easter message

President Tinubu Easter message

President Bola Tinubu wish Nigerians Happy Easter, and praise dem for all di sacrifices wey dem don make due to di economic palava for di kontri.

For inside one statement, President Tinubu say: ‘’Di sacrifice of Jesus Christ for humanity na strong lesson for leaders and all Nigerians to yield to selflessness and compassion, and to dey focused towards a united, peaceful, and prosperous nation.

"I commend Nigerians for all di sacrifices dem don make for di past few months to drive di nation to di path of recovery and sustainable growth, … di seeds of patience una plant dey grow and veri soon good fruits go plenti."

President Tinubu assure all citizens say Nigeria go overcome all di challenges wey di kontri dey face and add say im administration dey fully committed ontop dis mata.

Tens of thousands of worshippers gada for St Peter's square to hear Pope Francis lead Easter Sunday Mass.