List of Nigerians wey receive 2022 national honours award plus dia categories

Wia dis foto come from, Twitter/@tolu ogunlesi
Nigeria President Muhammadu Buhari on Tuesday confer national honours to 450 Nigerians and non-Nigerians, wey don distinguish demsef in di service of di nation and humanity.
Di president say citizens wey contribute to national development deserve to dey encouraged and appreciated.
Vice President Yemi Osinbajo and di President Chief of Staff, Ibrahim Gambari dey among big ogas wey attend di event wey take place for di International Conference Centre, Abuja.
Oga dem wey dey among di receipients of di 2022 National Honours Award for di category of Grand Commander of di Order of di Niger (GCON) na:
- Senate President Ahmed Lawan,
- Acting Chief Justice of Nigeria (CJN), Justice Olukayode Ariwoola,
- Immediate past CJN, Justice Ibrahim Tanko Muhammad,
- Director-General, World Trade Organisation (WTO), Ngozi Okonjo-Iweala,
- Deputy Secretary-General of UN, Amina Mohammed and
- Nigeria Permanent Representative to di UN, Prof Tijjani Muhammad-Bande.
Some oda recipients of di award for oda category include di president late Chief of Staff, Abba Kyari; Govnor Rotimi Akeredolu of Ondo State; Registrar of di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB), Ishaq Oloyede; di Minister of Works and Housing, Babatunde Fashola; Govnor Ifeanyi Okowa of Delta State plus odas.
Di Ooni of Ife HRM Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi Ojaja II and di Olu of Warri HRM Ogiame Atuwatse III get Commander of di Order of di Federal Republic (CFR) honour.
Popular Musician Teniola Apata, TENI receive di award of Member, Order of di Niger (MON) .

Wia dis foto come from, Government of Nigeria
Total of six pesins receive Grand Commander of di Order of di Niger, GCON honours.
End of Di one wey oda users dey read well well
55 pipo receive di Commander of di Order of di Federal Republic (CFR) honours.
65 pipo get di Commander of di Order of Niger (CON).
77 pipo receive di Officer of di Order of di Federal Republic (OFR)
110 pipo receive di Officer of di Order of di Niger (OON).
74 pesin get Member of the Order of di Federal Republic (MFR) and
55 pesin receive Member of di Order of di Niger (MON).
E get four recipients each for di Federal Republic Medal I (FRM I) and Federal Republic Medal II (FRM II) Second Class) respectively.
Di seven foreigners wey President Buhari honour receive di OFR Award.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

Wia dis foto come from, Government of Nigeria

Wia dis foto come from, Government of Nigeria
Wetin be dis National Honours Award

Wia dis foto come from, Twitter/@tolu ogunlesi
Di national honours awards dey established by di National Honours Act of No. 5 in 1964.
But e don bin take effect from October 1, 1963 before dem establish am.
Di Act empower di president by warrant, di Nigerian Order of Dignity to honour deserving citizens wey don contribute to di development of and progress of di kontri in any field of endeavour.
Di different honours and dia category

Wia dis foto come from, Government of Nigeria
See di category from top to bottom of di national honours award wey Nigeria dey give:
- Grand Commander of di Order of di Federal Republic of Nigeria (GCFR)
- Grand Commander of di Order of di Niger (GCON)
- Commander of di Order of di Federal Republic (CFR)
- Commander of di Order of Niger (CON)
- Officer of di Order of di Federal Republic (OFR)
- Officer of di Order of di Niger (OON)
- Member of the Order of di Federal Republic (MFR)
- Member of di Order of di Niger (MON)
- Federal Republic Medal I (FRM I)
- Federal Republic Medal II (FRM II)
Criteria wey dem use for di selection

Wia dis foto come from, Government of Nigeria
President Buhari tok during di events say di screening and selection of nominees for dis year (2022) award as always, follow established broad criteria, in accordance with di National Honours Act CAP.N43 of di Laws of di Federation of Nigeria 2004.
Dem include but not limited to:
‘‘consistent and meaningful participation in community and/or national development
"rendering unsolicited, selfless and philanthropic services to humanity;
"outstanding sacrifice in di defence of a cause popularly proclaim to be positive, relevant and beneficial to di nation and community.’’
Oda criteria listed by President Buhari for selecting di recipients na:
‘‘Distinct act of bravery for di protection and/or defence of national interest, public peace, safety of life and property.
‘‘Remarkable achievement in any field of expertise wia di pesin activities for dat field don make significant contributions to di attainment of national goals and objectives.
‘‘Serious contributions towards di uplift of community, state, nation and/or humanity through achievements by way of inventions and bringing outstanding honour and glory to di state through personal dedication and patriotic commitment.
"Service with integrity na also anoda strong ground for di selection process. "
How some of di recipients react

Wia dis foto come from, Facebook/@Sir Benedict Ayade
Govnor Ben Ayade of Cross River State post for im Facebook page foto of imsef dey collect di National Honours Award.
Ben Ayade write on to of di post say; "Commander of di Order of Niger (CON)."
And for anoda post, di govnor write say; "Dat feeling"

Wia dis foto come from, Government of Nigeria
Delta State Govnor, Ifeanyi Arthur Okowa thank di president and di National Honours Awards Committee for recognizing am as Commander of di Order of di Niger (CON) .
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Senator Ovie Omo-Agege tweet say im dey grateful say dem award am Commander of di Federal Republic (CFR), in recognition of im contribution to di advancement of nation building.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
African investor and philanthropist, Tony Elumelu say im dey humbled and honoured to receive 'Nigeria second highest national honour' - Commander of di Order of di Federal Republic (CFR)
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4











