Video show moment suspect jump on judge to attack am afta she deny am probation
Security video don show one defendant wey attack judge for Nevada courtroom for USA afta she deny am probation.
According to one statement, Judge Mary Kay Holthus “experience some injuries” afta she fall back from her seat.
Dem don carry di court marshal wey rescue di judge go hospital for treatment.
Di court bin dey sentence di defendant, Deobra Delone Redden, for one felony battery case. Dem don lay new charges against am.

Wia dis foto come from, Clark County District Court










