Bandits kill pipo for fresh attack on two churches in Kaduna

Kaduna church attack: Bandits kill pipo for fresh attack on churches in Kaduna
Wetin we call dis foto, File foto

Bandits on Sunday attack two churches and villagers for Kaduna, killing pipo, Police don confirm to BBC.

Tori be say di attackers also kidnap unspecified number of locals, according to security ogas inside di northwest Nigeria state.

Di bandits storm di villages on motorcycles, Kaduna State Police Command tok.

Dem begin from Ungwan Fada, and moving into Ungwan Turawa, before Ungwan Makama and then Rubu villages.

Inside Rubu village, di bandits attack worshippers inside Maranatha Baptist Church and St. Moses Catholic Church.

Mohammed Jalige, di state Police PRO confam wetin happun on Sunday afternoon.

Di Catholic Church Diocese wey dey cover Kaduna State don confirm say dia parish come under attack.

But Father Onyema, wey be Director of Social Communication for di Catholic Diocese say dem go provide details later.

Police name three villagers wey di attackers kill and also list those wey wound.

Di bandits also loot shops and cari some valuables from di villages waka.

E never dey clear which group dey behind di attack.

Sadly, e dey happun barely 48 hours afta authorities for Nigeria southwest state of Ondo do mass burial for 40 victims of Owo Church attack, earlier dis month.

Dis 19 June attack go make am at least five times since 2021 wey gunmen dey attack worshipers in churches for di northwest state.

On 31 October 2021, gunmen kidnap dozens of worshipers from Emmanuel Baptist Church, Kaduna.

E happun for Kakau Daji community, Chikun Local Government Area of di state as dem go worship on a Sunday.

Kaduna church attack: Bandits kill pipo for fresh attack on churches in Kaduna
Wetin we call dis foto, Grief and emotions flow for Owo town Friday morning (17 June, 2022) as mass funeral hold for victims of di church attack wey happun on Sunday June 5, 2022.

Who be di victims of dis Kaduna attacks?

Security officials for Kaduna state say dem don identify those wey dem kill:

Di dead include:

Peter Madaki (Ward head of Ungwan Fada)

Elisha Ezekiel (Resident of Ungwan Fada)

Ali Zamani (Youth leader of Rubu)

Meanwhile, those wey injure for di attack include two pesins.

Officials name one Aniro Mai, and a yet-unidentified woman.

Situation afta di attack

Security patrols dey happun for di general area as investigations proceed.

Dis na according to Samuel Aruwan, di Commissioner, Ministry of Internal Security and Home Affairs, Kaduna State.

Police Public Relations Officer Mohammed Jalige and di state police boss Yekini Adio Ayoku also confirm di situation.

Citizens go dey briefed on emerging developments, dem add.

Kaduna state under come under security threats win many bandits attacks in recent times.

Last year bandits storm one school inside Kaduna wia dem seize students.

Some of those students never still return home.

Kaduna govnor frown over di church attack

Di State Acting Governor don express sadness and strongly condemn di attack.

Hadiza Sabuwa Balarabe send her sincere condolences to di families of di victims.

She also pray for dia souls to rest in peace.

Di state chief executive also tell sorry give di attacked churches.

She pray for di speedy recovery of di injured.

Meanwhile, Kaduna State Commissioner for Internal Security and Home Affairs say di attack happun for different parts of Kajuru Local Goment Area of di state.

Samuel Aruwan say di gunmen attack worshippers for Maranatha Baptist Church and St. Moses Catholic Church for Rubu village.

Kidnapping in Nigeria

On June 3 June 2022, gunmen wey dey suspected to be terrorists storm di Catholic Church come kill 40 worshippers and injure several odas.

Di National Security Council don accuse fighters of Islamic State West Africa Province (ISWAP) say na dem of launch di attack.

Authorities never arrest anybody wey dey in connection with di attack.

Di weekend of June 12, na about 50 guests gunmen kidnap for Sokoto state northwest Nigeria.

Na as dem dey return to dia base for neighbouring Zamfara state after attending wedding of dia friend, attackers seize dem

Lately, from di kidnapping of di Primate of di Methodist Church of Nigeria for Abia to di seizing of two Catholic priests for one church inside Katsina state and oda unreported cases, tiff-tiff of humans dey threaten security across Nigeria.

On Monday, March 28, gunmen attack one train traveling from Abuja to Kaduna. Dem kill at least seven people, injuring many odas and kidnap some, while di rest dey miss.

One of di most fearful threats for families inside Nigeria nowadays na di frequent kidnapping of pipo, including schoolchildren from dia classrooms and boarding houses.

More than 1,000 students don dey kidnapped from dia schools since December 2020, many only released afta aft payment of randsom wey cost upto thousands of dollars.

Some of di kidnappers dey commonly referred to as "bandits" in Nigeria.

Dis ones dey raid villages, kidnap civilians and burn down houses.

Attacks by bandits don force thousands of pipo to even flee dia homes and seek shelter in oda parts of di kontri.

From north to south to west, east to north na thousands of pipo lives don lost across Nigeria sake of kidnappings since 2012.

And attacks still dey go on.

Hundreds of schools up north don dey closed following abductions at schools inside Zamfara and Niger state, wia children dem sieze as young as three years old.

By every indication, Nigeria lucrative kidnapping industry dey boom - e dey expanding into previously safe areas.

And di mata don dey look like say e dey beyond di control of di kontri military and security forces.

E don pose a real threat to trade and education, as well as di kontri farming communities.