Wetin you need to know as goment begin closure of Third Mainland Bridge

Third Mainland Bridge na one of di busiest bridge

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dis new closure of di bridge go begin for 9 January 2023

Di closure of di Third Mainland Bridge go begin on Tuesday 9 January for repairs according to goment.

No be di first time dem go close di bridge recently be dis but many motorist don begin dey fear say di traffic wey go happun for dat road go too much.

Many pipo don speculate say di alternative route wey dem provide go dey too congested and pipo go spend plenti time for traffic.

According to di controller of work for Lagos state Olukorede Kesha, plenti road traffic officers go dey deployed to monitor di road.

She tok for one interview wit Channels say men of di LATSMA go dey on stand-by to direct traffic.

Olukorede add say some traffic rules go dey relaxed so pipo no go dey punished for offences wey di closure of di bridge go cause.

Goment no tok how long e go dey closed.

Third Mainland Bridge na one of di busiest bridge for Nigeria wey dey for di kontri largest commercial city, Lagos state.

Dis closure of di bridge go affect di Iyana Oworonshoki-Adeniji Adele route wey be part of di popular route wey motorists dey drive everyday.

Earlier, goment bin announce di closure of some sections of di bridge for 6 November 2023 and di closure bin last for five weeks.

According to one circular , dis new closure na part of di ongoing work wey dem begin for November 2023 wia dem dey fix di ramps.

“..and now di remaining parts of di bridge go also dey repaired,” di circular tok.

Anoda new circular by Lagos state commissioner for transportation Mr. Oluwaseun Osiyemi, reveal say na di Federal Ministry of Works dey handle dis repair.

Di commissioner add say dem don make some arrangements wey go helep Lagosians ease di burden of di closure of di bridge.

Earlier, BBC Pidgin bin capture some portions of di Third Mainland Bridge wey bad.

Pipo wey dey pass di road bin complain say di potholes for di road dey cause constant traffic and tragic accidents for di axis.

Dis one make goment announce say dem go shutdown di road to repair.

Di state goment announce say di Lagos state public works corporation and di Federal Ministry of Works and Housing dey work togeda to carry out di repair work on di road.

Skip Facebook post
Allow Facebook content?

Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Facebook post

How di closure go work and alternative routes

Third Mainland Bridge na very busy route for many pipo wey dey work for di Island and wey wan access di Mainland. Di Lagos state goment tok. how di closure go happuns and di alternatives wey motorists fit pass.

  • Di bridge go dey open from midnight reach noon for pipo wey dey come from di Mainland to Island. E mean say pipo wey dey come from places like berger, Ketu, Ogudu, Oworonshoki, Ikeja fit access di bridge till noon time dem close am.
  • Those wey dey comot go di Island to Mainland no go fit access di bridge from midnight reach noon and dem go need us e di alternative wey be di Eko bridge. E mean say pipo wey dey go from places like Lekki, Ikoyi, Obalende go need to us di alternative route.
  • From noon to midnight, pipo go fit access di bridge from Island go Mainland. Those wey dey come from di Mainland go need use ko bridge.

Wetin e mean?

Di meaning be say, di bridge dey open from 12am to 12noon for those wey dey go from Mainland to Island. from Island to Mainland go use Eko bridge from 12am to 12noon (same time).

From 12noon to 12am, di bridge go dey open to doz wey dey go from Island to Mainland. Those from Mainland to Island from 12noon to 12am go need use Eko bridge.

Di commissioner explain say dis timing na sake of say na di period of wey flow of traffic dey plenty well well and make pipo cooperate wit di traffic officials.

Goment bin also close di bridge to carry out maintenance work for 2002

Wia dis foto come from, Getty

Different times goment don close third mainland bridge for repair works

Dis no be di first time wey di goment go close down di bridge sake of repair work.

For November 2023, Lagos goment bin close some parts of di Third Mainland Bridge sake of say dem wan do some repairs.

In recent times, dem bin close am for 2018, for 2019 and for 2020 for major repair work, wey last for six months.

Goment bin also close di bridge to carry out maintenance work for 2002 and 2012 according to Nigeria minister of transportation Rotimi Amaechi.

Lagos State goment shut down di Third Mainland Bridge from midnight of Thursday 23 August to midnight of Sunday 26 August 2018 to cari out Investigative Maintenance Test.

Goment also do few days closure for 2018 and 2019 to check weda di bridge still dey ok, na di report wey dem compile from 2019 check na im dem use decide to work ontop di bridge for 2020.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Third Mainland Bridge history

Di Third Mainland Bridge na di longest bridge for Africa bifor, until 1996 wen dem build 6th October Bridge wey dey Cairo, Egypt.

Di bridge start from Oworonshoki wey dey linked to di Apapa-Oshodi expressway and Lagos-Ibadan expressway, and end for di Adeniji Adele Interchange on Lagos Island.

E also get link midway through di bridge wey lead to Herbert Macaulay Way, Yaba.

Na Julius Berger Nigeria PLC na im build di Third Mainland Bridge. Di phase one of di project na President Shehu Shagari cut di tape alias commission am in 1980 and na President Ibrahim Babangida complete am in 1990.

Di length of di bright fit measure about 11.8 km long and na di longest of di three bridges wey dey connect Lagos mainland to Lagos Island.