Loyal dog wey no comot from im owner grave for 10 years inspire new law for Brazil

Wia dis foto come from, PATRE
- Author, Maia Davies
- Read am in 2 mins
One dog wey spend 10 years living inside São Paulo cemetery wia dem bury im owner don inspire one new law wey permit di burial of pets with dia families for di Brazilian state.
Bob wey dem Nickname Bob Coveiro - meaning "gravedigger" for Portuguese - na loyal dog wey bring comfort to mourners and become a constant for di graveyard until im death for 2021, wen dem bury am alongside im guardian.
Di law wey dem name after di dog come into effect on Tuesday and recognise di "emotional bond" between pets and dia human families, di state govment tok.
One of im authors, representative Eduardo Nóbrega, write on social media: "Wetin begin as a story of love and loyalty don turn into public policy."
Bob bin attend im owner funeral for di cemetery for Taboão da Serra and no gree leave after, Brazilian media report - e even return wen family members try to carry am go house.
Dem give am green dog house to live for dia and pipo bin sabi am say e dey follow funeral processions for di site, wia dem eventually bury am with im owner after car hit am for 2021.
Local animal protection charity Patre, wey lead one fundraiser for one statue for im memory, say Bob win di hearts of everyone wey meet am".
E tok for statement: "Pipo wey dey sad by burying dia loved ones go manage to smile wen di little dog, wey bin dey crazy about balls, try to play."
Nóbrega tok about di Bob Coveiro Law on Wednesday say: "Anyone wey don lose a pet know say: no be just animal. Na family. And dia law recognise dis bond, bringing more respect at di moment of farewell."
"Love no dey end at goodbye," e write for social media.
E mean say cats and dogs now fit dey buried inside family graves for di southeastern state - Brazil most populous - provided say sanitary standards dey met, with local funeral services to determine di rules to do so.
Brazil get di world third largest pet population, with 160 million animal companions, according to data from di Pet Brasil Institute.






