'Six years later, she still no fit resist me!' - Regina Daniels husband poem to her totori pipo

Read am in 4 mins

Nigerian Senator, Ned Nwoko write one 24 stanza poem wey e post for im social media handle, to celebrate im sixth year marriage anniversary wit im wife, actor, Regina Daniels.

E also announce say dem dey expect dia third child.

Oga Ned for di poem bin tok about di past years wey im and Regina don be togeda.

E express im deep affection for her, describe dia union as one strong love wey don endure challenges and still dey stand.

Di senator post dey come afta one recent tori bin go round about im and Regina marriage.

For February, Regina bin comot Ned Nwoko name from her bio, deleting all pictures wia e show for her Instagram page.

Dis one happun as tori bin dey fly around dat time say one Nollywood actress dey pregnant for oga Ned.

Sometin wey di senator and di actress say no be true.

Oga Ned tok about dia children and how Regina dey take care of dia two sons.

E further address di rumours, di tori of crisis for dia marriage say no be true.

"Dis morning, feeling bold, and true, I bin send you a message, out of di blue: 'Will you marry me?'.

"Your laughter pour out like golden rays. 'Hahahahaha! Always! Di biggest YES!' Oh, my queen, you love me so truly. Make I gather di elders, pay di price? For you, I go do am all anew!" Part of di senator poem read.

Senator Ned Nwoko also address pipo wey dey tok about dia expectations for im marriage, "dey whisper of love for measured tones, As if hearts dey caged, made of stone. But ours, Regina, dey fierce and wild, A dance of fire, God own child.

"Some claim faith but live in disguise, Preach devotion wit wandering eyes. Yet here we stand, bare and true, no lies to hide, no games to rue.

"A good man, monogamous or not, dey bring peace to di home, keep am hot. Better to love wit honesty bold, dan sell a dream wrapped in fool's gold."

Bloggers dey always link Senator Ned Nwoko to news wey concern polygamy - di latest one na dis link to popular actress Chika Ike.

For 2023 and 2024 tori bin fly again say im wan marry actress Chika Ike. Na dat tori wey start to spread again afta she post pregnancy fotos.

Rumours by local tori pipo dey always wan link female entertainers to billionaire politicians or businessmen for Nigeria.

Ned Nwoko na politician wey dey represent Delta North Senatorial District, na former House of Representatives member.

Di politician recently defect from opposition party, di Peoples Democratic Party (PDP) to di All Progressives Congress (APC).

For recent interview wit BBC Pidgin, Ned Nwoko wey tok say im focus na to work for im pipo explain say one of di reasons wey make am jump from PDP and APC na to get Anioma State wey im pipo don dey fight for since over 50 years.

But for di recently proposed 'new states' wey di House of Representatives bin do, Anioma State no dey inside.

Early, Ned Nwoko wife, Regina Daniels Nwoko, bin tok for one BBC Pidgin interview say, she and her husband and co-wives no get any issue at all.

She also say she fit enta politics one day as she go continue to support her husband.

Di mother of two, dey always hail her husband evritime for social media, but Nigeria begin tok say she no chook mouth for her husband defection and she also deactivate her Instagram account.

Dis two tins na im follow make di tori wey dem tok say na fake new waka far.