You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
How Islamic police arrest Muslims dem catch wey no gree fast during Ramadan
Di Islamic police for Kano state, northern Nigeria arrest 11 Muslims on Tuesday wey dem catch as dem dey chop food during di Ramadan fast.
Kano get plenti Muslim population, and di Islamic legal system - Sharia dey work for dia well-well wit secular law.
Di Islamic police, wey pipo sabi well-well as Hisbah, dey search eateries and markets evri year during Ramadan.
Dem release di 10 men and one woman wey dem arrest afta dem swear oath say dem no go purposely miss di fasting again.
"We catch 11 pipo on Tuesday including one lady wey dey sell groundnuts, she bin dey eat from di groundnuts she dey sell and some pipo alert us," Hisbah tok-rok pesin Lawal Fagge tell di BBC.
"Di oda 10 na men and we arrest dem across di city especially close to di markets wia plenti activities dey happun."
Im add say di search operations go continue but explain say pipo wey no be muslims no follow.
"We no dey arrest pipo wey no be Muslims sake of say dis fast no concern dem and di only time wey dem fit dey guilty of crime na wen we find out say dem cook food to sell to Muslims wey suppose to dey fast."
End of Di one wey oda users dey read well well
Im explain say dem don already release di men wey dem arrest afta dem promise to start fasting from now on and "for some of dem we need to see dia relatives or guardians so dat dia family go monitor dem".
Na small tin e take pass 20 years ago, wey dem introduce Sharia to work alongside secular law for12 northern states for Nigeria wey get plenti Muslim population.
Wetin be Ramadan
Ramadan na di ninth month of di Islamic calendar. E get special significance for Islam.
Na during dis month wey Muslims believe say di first verses of di Quran - Islam holy book - dey revealed to di Prophet Muhammad.
Fasting na one of di Five Pillars of Islam, wey lay di basis for how Muslims suppose live dia lives. Na for daytime dem dey observe di fast.
Dis year, Ramadan dey expected to last 30 days, wit fasting wey start on Monday 11 March and e fit end on Tuesday 9 April.