Man United, Liverpool game make Premier League table tight

Manchester United vs Liverpool

Wia dis foto come from, Getty

Wetin we call dis foto, Manchester United celebrate dia second goal against Liverpool

Di race for di Premier League title don tight pass before as Manchester United and Liverpool play 2-2 for Old Trafford.

Liverpool score first for di 23rd minute thru Diaz for di first half before Manchester United score for di 50th minute inside second half.

Liverpool and Manchester United bin get plenti chances ton score but di match tight well well.

Later, Machester United score to take di lead wen Mainoo score before dem foul Liverpool player Darwin Nunez wey result to penalty.

Mohamed Salah score di penalty to end di match for 2-2 draw.

As e be so Arsenal and Liverpool tie wit 71 points for first and second positions while Manchester City sitdown for third position wit 70 points.

Second Half

Full Time Manchester United 2-2 Liverpool

90+ 7 Match don end

89' Liverpool midfielder Curtis Jones bring down Rasmus Hojlund for di centre circle and e collect yellow card.

85' Substitution! Mason Mount replace Kobbie Mainoo for Manchester United.

84' Goal! Liverpool don score Mohamed Salah take di penalty

Salah has to wait a while to take it and sends Andre Onana the wrong way.

Still six minutes for Liverpool to find a winner.

82' Penalty! Harvey Elliott play one-two wit Mohamed Salah e carry di ball pass Aaron Wan-Bissaka, wey bring am down.

Penalty.

81' Yellow card! Manchester United keeper Andre Onana collect card for time wasting Referee no overlook am dis time.

77' Imagine say Joe Gomez bin get im first ever goal for dis game! Di ball drop to di Liverpool defender 20 yards out and im get crack. Na big deflection off Harry Maguire and Andre Onana save am.

76' Manchester United goalkeeper Andre Onana take waste plenti time just to play goal-kick. im get luck say dem no give am card, e waste plenti time.

75' Yellow card for Manchester United centre-back Willy Kambwala.

74' United troway chance to increase dia lead. Na Alejandro Garnacho first-time shot from 16 yards but e go straight to di Liverpool keeper.

72' Manchester United keeper Andre Onana try to step around Cody Gakpo e nearly succeeds sha.

69' E be like say Jurgen Klopp dey vex and e don make double change. Cody Gakpo and Harvey Elliott replace Darwin Nunez and Wataru Endo.

Manchester United 2-1 Liverpool

67' Goal! Manchester United youngster Kobbie Mainoo gets the ball near di edge of di box, im turn and then curls an absolute stunner into di top corner.

Caoimhin Kelleher no fit near am.

62' Darwin Nunez battle to get pass wey Mohamed Salah misplaced pass but den e just plays di ball to Andre Onana.

59' Second time inside few minutes wey Marcus Rashford dey cause kasala but Caoimhin Kelleher dey save dem.

55'Liverpool first chance since dat goal na dis rapid counter wey end for Darwin Nunez leg but e tries to square am instead of shooting and di opportunity d waka pass.

Manchester United 1-1 Liverpool

50' Goal! Manchester United don draw level wit dia first shot and na from di centre circle.

Liverpool defender Jarell Quansah turns around as im play blind pass wey go meet Bruno Fernandes from good 50 yards out.

Without even blinking di United captain shoots and Caoimhin Kelleher, who dey. di edge of im box, no fit save am.

46' Liverpool shot before di clock for di second half even show, but e gowide from Darwin Nunez

First Half

Half time Manchester United 0-1 Liverpool

45+2 First Half don enta afta referee add two extra minutes.

44' Andre Onana comot from im line to stop Mohamed Salah beta ball make e no enta di box as e try find Darwin Nunez. Di match na one-way traffic.

Manchester United vs Liverpool

Wia dis foto come from, Getty images

43' Bruno Fernandes play di ball go down left to meet Alejandro Garnacho.

40' Manchester United midfielder Casemiro kick di ball out so Luis Diaz fit get treatment afta Willy Kambwala tackle am. E be like say di home fans like wetin e do.

38' Liverpool goalkeeper Caoimhin Kelleher clearance go meet Willy Kambwala for di centre circle but im no fit find any of im team mates quick.

34' Liverpool get a five-on-four situation. Luis Diaz find Mohamed Salah, wey United golkeeper Andre Onana push im first-time shot from 20 yards.

Salah suggest say Diaz for play di ball just behind wia im bin want am.

From di corner, Salah shoots from almost di same position and Onana push am comot again.

Manchester United vs Liverpool

Wia dis foto come from, Getty Images

29' United defender Willy Kambwala almost allow Darwin Nunez pass thru but im recover sharp sharp to slide in and win di ball back.

27' Bruno Fernandes play di ball as im try to pass Alexis Mac Allister, wey bring am down. United get free-kick about 35 yards out.

Manchester United 0-1 Liverpool

23' Goal! Liverpool don score! thru Luis Diaz

17' So far, Liverpool don get five shots and four of dem land for Dominik Szoboszlai.

Manchester United neva get even one.

16' Marcus Rashford of Manchester United passs one beta ball from im left to Rasmus Hojlund. Alejandro Garnacho dey free for di middle but Virgil van Dijk no let di United striker see am well..

13' Good recovery from Manchester United defender Diogo Dalot wey stop Dominik Szoboszlai's flick wey send Darwin Nunez thru. E for be one on one for di Uruguay player.

11' Darwin Nunez of Liverpool add pressure to win di ball from Kobbie Mainoo on di right. Im lift one cross to Mohamed Salah, wey volley di ball but e deflect wide off Aaron Wan-Bissaka.

7' Yellow card for Liverpool defender Conor Bradley sake of foul.

3' A big chance for di two ends of di pitch. Mohamed Salah make one bet run s e Dominik Szoboszlai for di box. Di Liverpool midfielder' fire shot but Andre Onana stretch out im arm save am

2' Disallowed Goal! for Manchester United

Alejandro Garnacho put di ball for back of di net but di assistant referee raise flag up.

1' Referee don blow whistle and match don start

Manchester United manager Erik ten Hag say players go dey "angry" wen dem face Liverpool and call on dem to "bring big games over di line".

United bin concede twice for stoppage time for one dramatic 4-3 loss to Chelsea on Thursday, five days afta dem allow one 99th-minute equaliser for Brentford.

Doz results don leave dem sixth for di table bifor dem host Jurgen Klopp title-chasers on Sunday (15:30 BST).

"We need to step up and make better decisions,"Ten Hag tok.

Di five points United don drop late for dia past two league games don leave dia hopes to qualify for next season revamp Champions League dey hang by thread.

But Ten Hag add say: "We fit play to one very high standard. We fit compete wit di best and beat di best for di Premier League. Wen you fit do dat, you fit also do am across Europe.

"We need to learn how to bring big games over di line."

Wit di top five for English football top flight set to earn one place for Europe elite club competition next season, United trail fifth-place Tottenham by nine points wit eight games left and dey 10 behind Aston Villa for fourth.

Dey don win for both occasions dey don face Liverpool for Old Trafford since Ten Hag bin take charge for 2022, including one rise and fall FA Cup quarter-final last month wey finish 4-3.

And di United boss tok say e want im players to use di disappointment wey dey experience for Chelsea - wen Cole Palmer bin score for di 10th and 11th minutes of injury time - to fuel one victory bid against dia old rivals.

"We need to recover very quick," Dutchman Ten Hag tok. "We need to turn dis around. We go be for one positive mood and we go dey look forward.

"We need to take energy but we go dey mad, angry. From anger you fit take lot of energy and dat na how we need do am."

Line -Ups

Manchester United starting 11: Onana, Wan-Bissaka, Maguire, Kambwala, Dalot

Casemiro, Mainoo, Garnacho, Bruno Fernandes, Rashford, Højlund

Liverpool starting 11: Kelleher, Bradley, Quansah, van Dijk, Robertson, Mac Allister, Endo, Szoboszlai, Salah, Núñez, Díaz