You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Killing of five soldiers and six civilians - Different times Nigerian military suffer attacks allegedly by Ipob/ESN
Once again di Nigeria military don promise to deal seriously wit di jaguda pipo wey attack and kill dia troop for Obikabia Junction Checkpoint for Abia State, southeast Nigeria.
Di military allege say na di proscribed Indigenous People of Biafra (Ipob), and dia armed wing, Eastern Security Network (ESN), carry out di attack.
According to di military, attack on di troops of Operation Udoka happun on 30 May wen "Ipob/ESN inside three tinted Prado Toyota SUV plus oda pipo from di area, allegedly do surprise attack, kill eleven pipo, five soldiers and six civilians."
Dem say di troops bin dey di area to enforce peace and protect di residents.
For one statement by di Director of Defence Media Operations, Major General Edward Buba, di military go retaliate against di killings.
"Di military go dey fierce for im response. We go bring overwhelming military pressure on di group to ensure dia total defeat,” di statement tok.
In recent year, dis kain attack don dey dey more and more common for di southeast of Nigeria wia separatists dey demand say dem want dia own independent kontri.
According to Nextier SPD Violent Conflict Database, inside di first five months of 2021 for example, dis gbas gbos between alleged Ipob members and Nigeria security agents don lead to di death of nine of dem for Ebonyi state; 25 for Imo state; Anambra and Abia 12 and 14 security agents die respectively; and six for Enugu State.
End of Di one wey oda users dey read well well
Since den, attacks on security agents don increase.
Times wey Nigerian military suffer attacks for southeast
Di Nigerian military don suffer attack from alleged Ipob/ESN members in recent times and some of dis attacks claim lives of troops.
Okija
On 19 April 2024 ESN militants bin allegedly kill one soldier, wunjure two odas.
Di gunmen wey bin carry AK-47 inside two Lexus motor and okada do surprise attack for Okija, Ihiala local goment area of Anambra State.
Awo-Omamma
Di killing of one soldier for Awo-Omamma inside Imo State on 22 November and di gbege wey bin follow afta di killing cause serious panic for di pipo of di area.
Some jaguda pipo bin go Ishieke junction for Awo-Omamma attack troops wey bin station dia.
Ehime Mbano
On 19 September 2023, gunmen open fire on one joint security patrol for Umualumak community for Ehime Mbano local goment area of Imo State.
Di members of Operation Search and Flush bin dey drive inside two pickups wen jaguda pipo open fire on dem.
Di gunmen also burn di deadi-bodi of di soldiers and police wey dem kill.
Wetin cause Ipob/ESN agitation for southeast
Di Indigenous People of Biafra (IPOB) and im paramilitary wing, di Eastern Security Network (ESN), according to Nigeria police, allegedly dey involved for di disturbances wey dey shele for southeast sake of say dem dey fight for independent kontri, wey dem dey call Biafra.
Na British-Nigerian political activist Nnamdi Kanu establish Ipob for 2012 to revive di quest for Biafran independence, wey bin dey dormant since di end of di Nigerian Civil War for 1970.
Kanu use of media platforms, particularly Radio Biafra, bin make Ipob popular for di southeast.
Ipob dey allege marginalisation and economic neglect of di southeastern region, wey dey predominantly inhabited by di Igbo ethnic group.
But Kanu wey dey Nigeria secret police custody and dey face accuse of treason by Nigerian goment, don deny say im get hand for di killings and attacks on security personnel wey dey happun for Nigeria southeast region.
Di quest for Biafran independence get deep historical roots wey date back to di Nigerian Civil War (1967-1970), wen di southeastern region bin attempt to stand as Republic of Biafra. Di war bin end wit di reintegration of Biafra into Nigeria, but many Igbos believe dia region don continue to face discrimination and neglect since den.
Ipob and dia supporters tok say di southeastern region don dey economically marginalised by di federal goment, wit inadequate infrastructure, poor federal investment, and limited political power compared to oda regions for Nigeria.
E get perception among many for di southeast say dem dey underrepresented for Nigeria political structure and decision-making processes. Dis perception fuel support for Ipob separatist agenda.