Top five health benefits of garlic

Wia dis foto come from, Yulia Naumenko/Getty Images
Garlic na small bulb wey get strong smell and taste wey evribodi sabi. E dey inside almost evri kitchen for di world. But no be just to make food sweet, pipo don dey use garlic as medicine for thousands of years.
For interview wit BBC News Pidgin, dietitian Sa'aadu Sulaiman from Kano say: "Most of garlic beta health benefits come from special tins inside am wey dem dey call sulphur compounds, like allicin. Dis one dey active well-well wen you crush or chop fresh garlic."
Health benefits of garlic
Dis na some of di health benefits of garlic, according to Dietitian Sulaiman:
- E dey boost your immune system: Garlic strong well-well for making your bodi fight sickness. E get antibacterial, antiviral, and antifungal power wey dey help fight common cold, flu, and oda infections.
- E dey protect your heart: Garlic dey help your heart by lowering blood pressure, reducing cholesterol, and making your blood vessels work beta.
- Na strong antioxidant: Garlic full wit antioxidants - dem be like small bodyguards wey dey protect your body cells from damage. Dis kain damage fit cause long-term sickness and make pesin age fast.
- E good for bone: Some research show say garlic fit help bone health, especially for women, becos e fit affect oestrogen level.
- E fit help prevent cancer: Many studies don show say garlic fit help protect against different cancer like stomach, breast, lung, and prostate cancer. Even just one big raw garlic clove (crushed) fit begin change how your body dey fight cancer within few hours. Pipo wey dey chop garlic steady get lower chance of stomach cancer.
Na evribodi garlic good for?
British Dietitian Association tok-tok pesin and paediatric dietician, Bahee Van de Bor, say garlic fit worsen stomach issues for some pipo.
"Unfortunately, e fit trigger for some individuals, particularly dose wit IBS. Therefore, e dey crucial for anyone, including children wit IBS, to identify dia personal tolerance levels to garlic," Van de Bor tok.
E add: "A great workaround to enjoy dat rich garlic flavour na to use garlic-infused oils for cooking.
"However, e dey worth to note say while dis method dey reduce di risk of triggering IBS symptoms, di oil typically contain lower levels of allicin, di compound wey dey responsible for many of garlic health benefits."
Nutritional profile
Garlic; raw (per 100g) get about:
- Energy: 149 Kcal
- Carbohydrate: 33.06g
- Fibre: 2.1g
- Protein: 6.36g
- Fat: 0.50g
- Iron: 1.70mg
- Folate: 3µg
- Cholesterol: 0mg
- Saturated Fat: 0.083g
- Monounsaturated Fat: 0.006g
- Polyunsaturated Fat: 0.251g









