You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'E don craze finish' - How Trump react to Putin latest move on Ukraine
- Author, Jaroslav Lukiv
- Role, BBC News
- Read am in 3 mins
US President Donald Trump say e "no happy" wit im Russian counterpart Vladimir Putin, after Moscow largest aerial attack on Ukraine.
For response wey no dey common, Trump say: "Wetin happen to am? E dey kill a lot of pipo." E later call Putin "absolutely crazy".
Ukrainian President Volodymyr Zelensky bin don earlier say Washington "silence" over recent Russian attacks dey encourage Putin, as e call for "strong pressure" - including tougher sanctions - on Moscow.
At least 12 pipo dey killed and odas injure, - na di di highest number inside a single night since Putin launch a full-scale invasion in 2022.
Air sirens wey dey warn of incoming drones and missiles sound again in many regions of Ukraine early on Monday.
At least three pipo, including one child, injure for di north-eastern city of Kharkiv, Mayor Ihor Terekhov tok.
For di southern Zaporizhzhia region, two pipo bin injure, regional head Ivan Fedorov tok.
For Russia, Moscow Mayor Sergei Sobyanin say two Ukrainian drones wey bin dey head towards di capital bin dey destroyed by air defence units. No injuries dey reported.
Speaking to reporters for New Jersey late on Sunday, Trump tok about Putin say: "I' don sabi am for a long time, I bin always dey get along with am, but e dey send rockets into cities and dey kill pipo, and I no like am at all."
Wen dem ask am about weda e dey consider increasing US sanctions on Russia, Trump reply say: "Absolutely." Di US president don repeatedly threaten to do am before - but neva yet implement any restrictions against Moscow.
Shortly afterwards, Trump write inside post ontop Truth Social say Putin "don go absolutely crazy".
"I don always tok say e want all of Ukraine, not just a piece of am, and maybe dat dey prove to dey right, but if e do am, e go lead to di downfall of Russia!"
But di US president also get strong words for Zelensky, e say e no "dey do im country any favours by talking di way e dey do".
"Everything out of im mouth dey cause problems, I no like am, and e better stop," Trump write of Zelensky.
Despite Kyiv European allies wey dey prepare further sanctions for Russia, US don say e go either continue to try to organise dis peace talks, or "walk away" if progress no follow.
Last week, Trump and Putin do one two-hour phone call to discuss a US-proposed ceasefire deal to stop di fighting.
US president bin say e believe say di call bin go "very well", adding say Russia and Ukraine go "immediately start" negotiations toward a ceasefire and "an end to di war".
Ukraine bin don publicly agree to a 30-day ceasefire.
Putin don only say Russia go work with Ukraine on a "memorandum" on a "possible future peace" - a move wey Kyiv and im European allies describe as delaying tactics.
Di first direct Ukrainian-Russian talks since 2022 happen on 16 May for Istanbul, Turkey.
Aside from a major prisoner of war swap last week, little or no progress dey on pausing di fighting soon.
Russia currently dey control about 20% of Ukrainian territory. E include Crimea - Ukraine southern peninsula wey Moscow collect for 2014.