Easter date, Workers day, Salah date Eid-ul-Maulid plus oda public holidays for 2023

Nigeria goment don declare Wednesday, 27 September 2023 as Public Holiday.

Dis latest announcement na to celebrate Eid-ul-Maulid, di birth of di Holy Prophet Muhammad.

Di Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo wey announce di holiday advise Nigerians to imbibe di spirit of love, patience, tolerance and perseverance wey be deep spiritual virtues wey Holy Prophet Muhammad show.

E also advice di youths to embrace di virtues of hard work and peace wit oda pipo, irrespective of dia faith, ideology, social class and ethnicity.

Eid-ul-Maulid na one of di public holidays wey Nigerians dey celebrate.

Public Holidays for Nigeria for 2023 go reach 16 times.

Dis holiday mean say banks, businesses, schools and goment offices no go dey open dat day.

E go also help pipo to plan dia calendar well-well. 

Public Holidays in Nigeria 2023

  • 1 January - Sunday - New Year Day
  • 2 January - Monday- New Year Day Holiday (Dis na because di New Year fall on Sunday)
  • 7 April - Friday - Good Friday
  • 10 April - Monday - Easter Monday
  • 22 April - Saturday - Eid-el Filtri
  • 23 April – Sunday - Eid-el Filtri
  • 1 May - Monday - Labour Day
  • 27 May - Saturday - Children Day (Public Holiday for Schools and Children only)
  • 12 June - Monday - Democracy Day
  • 29 June - Thursday - Eid el Kabir
  • 30 June - Friday - Eid el Kabir
  • 27 September - Wednesday - Eid el Maulud
  • 1 October - Sunday - National Day
  • 2 October - Monday - National Day Holiday (Dis na becos di National Day on Sunday)
  • 25 December - Monday - Christmas Day
  • 26 December - Tuesday - Boxing Day

How Federal Goment dey announce Public Holidays

For Nigeria, na di Ministry of Interior get power to announce Public Holidays for di kontri.

And di oga for di Ministry na Rauf Aregbesola, wey pipo also sabi as 'Public Holiday Minister'.

Oga Aregbesola go announce di days goment give as 'work free' day for all civil seravnts.

Anoda tin be say if any public holiday fall for week end, dem go declare di following week day as Public holiday.

Di reason na to compensate for di weekend wey pipo dey already master to rest from work.