How oil spill for Rivers community take cause heartbreak for family of 76-year-old fisherman
How oil spill for Rivers community take cause heartbreak for family of 76-year-old fisherman

- Author, Karina Igonikon
- Role, Reporter, BBC News Pidgin
Wen BBC see 76-year-old Igwe Chinwi, e bin dey return from farm wey dey four miles away from im house for Aleto. E dey sad say e return empty-handed.
Oga Chinwi wey be fisherman and farmer, say oil spill wey happun for im community dey give am heartbreak as e don spoil im source of living.
E tell BBC say since di spill happen on Sunday 11 June, 2023, e never catch one single fish as all di fish dem don die. Even im farm dey suffer as evritin e plant do die finish.
Di oil spill happen sake of breakdown of di Trans-Niger pipeline wey belong to Shell Petroleum Development Company (SPDC), for Esite-Aleto community for Eleme LGA of Rivers State.
Di company say dem dem investigate di mata.
Video Jouurnalist : Olawale Adekola






