New service chiefs biography: Tinubu appoint Ikechukwu Ogalla, Bala Abubakar, Kayode Egbetokun, Taoreed Lagbaja and Christopher Musa

Lagbaja, Ogalla,Egbetokun, Abubakar

Wia dis foto come from, NTA

Wetin we call dis foto, President Bola Tinubu appoint new Service Chiefs and odas

Nigeria President Bola Tinubu on Monday approve di immediate retirement of all Service Chiefs, di Inspector General of Police, Usman Alkali-Baba and di Comptroller-General of Customs, Hameed Ibrahim Ali.

Di Nigeria leader appoint new pipo to replace dem wit immediate effect.

Di Director of Information, Willie Bassey announce dis informate on behalf of di Secretary to di Government of di Federation, George Akume.

For inside di statement, di Nigerian leader announce di appointment of Mallam Nuhu Ribadu as di National Security Adviser.

Di only security Chief from di last administration wey still remain for office na Director General of Department of State Security, DSS,Yusuf Magaji Bichi.

Dis na di new security chiefs and dia profiles:

Maj. T. A Lagbaja - Chief of Army Staff

COAS

Wia dis foto come from, Nigeria Army

Dem born Major General Taoreed Lagbaja na indigene of Ilobu, Irepodun Local Goment Area, Osun State, southwest Nigeria for 28 February 1968.

E enter di Nigerian Defence Academy for 12 September 1987 as member of 39th Regular Course.

Dem commission as 2Lt for 19 September 1992 for di Nigerian Army Infantry Corps.

E become Major General for 12 September 2019.

Major General Lagbaja don hold plenti ogbonge positions within di army and e get different projects wey im commission to im name.

Before in appointment, na im be di General Officer Commanding. Headquarters 1 Division.

E work as di Commander., Headquarters 9 Brigade, Ikeja, Lagos State - December 2018 - April 2019.

Amond oda position wey e hold na Commander, Headquarters 2 Brigade, Uyo, Akwa Ibom State - April 2019 - January 2020.

Rear Admiral Ikechukwu Ogalla - Chief of Naval Staff

Ikechukwu Ogalla

Wia dis foto come from, NTA

Wetin we call dis foto, Chief of Naval Staff

Dem born Rear Admiral Emmanuel Ikechukwu Ogalla for December 20, 1968 for Enugu state, Southeast Nigeria.

Rear Admiral Ogalla bin start early for military as e bin gbab im West African School Certificate from NMS Zaria for June, 1987

E bin hold BSc for Mathematics. E get MSc Strategic Studies programme, University of Ibadan.

Dem commission am as Lt for September 16, 1992 and e rise to di rank of R Adm wef for 16 September 2021.

E also don contribute to di growth of di Nigerian Navy for oda aspect including research tours for kontris like China and South Korea.

E bin serve for board of many ships including NNS AMBE, ARADU, LANA, EKUN, AGU, QUORRA, BEECROFT, DELTA and PATHFINDER.

AVM H.B Abubakar - Chief of Air Staff

Air Vice Marshal Hassan Bala Abubakar

Wia dis foto come from, NAF

Wetin we call dis foto, Chief of Air Staff Air Vice Marshal Hassan Bala Abubakar

Dem born Air Vice Marshal Hassan Bala Abubakar for 11 September 1970 for Shanono Local Government Area for Kano State, Northwest, Nigeria.

Abubakar enlist into di NAF as member of NDA RC 39 and commissioned Pilot Offr for 19 September 1992.

E get Bachelor of Science Degree from di Nigerian Defence Academy Kaduna Master's Degree for International Affairs and Diplomacy from ABU Zaria.

Bifo im appointment as Oga of Navy, Air Vice Marshal Abubakar bin hold some appointments wey include:

Aviation Planning Officer, MONUC Air Operations Kinshasa, DRC. Team Leader MILOB Team Site 615 Mahagi (Ituri Brigade) MONUC among odas.

DIG Kayode Egbetokun - Acting Inspector-General of Police

Acting IGP Kayode Egbetokun

Wia dis foto come from, NPF

Wetin we call dis foto, Acting IGP Kayode Egbetokun

Dem bornBorn acting IGP Kayode Egbetokun for 4th September, 1964 for Egbado South Local Goment Area of Ogun State, southwest Nigeria.

Egbetokun dey enlisted into di Nigeria Police Force as Cadet ASP (Course 16) for March 3, 1990.

Bifo im appointment as acting oga of police, Egbetokun don hold different ogbonge position for Lagos, Kwara and oda states across di federation.

Egbetokun bin serve as di Chief Security Officer to Tinubu wen e be govnor for Lagos from 1999-2005.

E also be Commander RRS Lagos State Command 2005-2007.

Before im appointment, e be DIG Force Criminal Investigations Department, FHQ, Abuja.

Maj. Gen. C.G Musa - Chief of Defence Staff

Chief of Defence Staff Christopher Gwabin Musa

Wia dis foto come from, NA

Wetin we call dis foto, Chief of Defence Staff Christopher Gwabin Musa

Dem born Chief of Defence Staff Christopher Gwabin Musa for 25 Dec 1967 for Sokoto state.

E be indigene of Zangon Kataf for Kaduna State, Northwest, Nigeria.

Di CDS be Member of di 38th Infantry Course Nigerian Defence Army.

Dem Commission am for 21 September 1991.

Before im appointment, e be Theatre Commander JTF (NE) Op HADIN KAI - 2021.

Nuhu Ribadu (National Security Adviser)

Nuhu Ribadu

Wia dis foto come from, Twitter/@BenMurayBruce

Earlier on, Tinubu bin appoint Nuhu Ribadu as im Special Adviser on Security. But for dis new list of appointment, e don upgrade am to National Security Adviser.

Apart from serving as Economic and Financial Crimes Commission, EFCC oga from 2003-2007, e also contest to be Nigeria president for 2011.

Policeman by profession, dem born Ribadu for 1960 for Adamawa state and na dia e start im education until 1980 wen e get admission to study law for Ahmadu Bello University Zaria.

E join police few years afta e leave Law School and e serve for 18 years before e retire for 2007.

Ribabu also bin serve as Chairmo of Petroleum Revenue special task force under President Goodluck Jonathan.

Oda appointments wey Tinubu make

  • Col. Adebisi Onasanya - Brigade of Guards Commander
  • Lt. Col. Moshood Abiodun Yusuf - 7 Guards Battalion, Asokoro, Abuja
  • Lt. Col. Auwalu Baba Inuwa177 - Guards Battalion, Keffi, Nasarawa State
  • Lt. Col. Mohammed J. Abdulkarim - 102 Guards Battalion, Suleja, Niger
  • Lt. Col. Olumide A. Akingbesote - 176 Guards Battalion, Gwagwalada, Abuja

Similarly, di president don also approve di appointments of oda Military Officers for di Presidential Villa as follows:

  • Maj. Isa Farouk Audu - (N/14695) Commanding Officer State House Artillery
  • Capt. Kazeem Olalekan Sunmonu (N/16183) Second-in-Command, State House Artillery
  • Maj. Kamaru Koyejo Hamzat (N/14656) Commanding Officer, State House Military Intelligence
  • Maj. TS Adeola (N/12860) Commanding Officer, State House Armament
  • Lt. A. Aminu (N/18578) Second-in- Command, State House Armament

Di Nigeria leader also approve di appointments of two (2) additional Special Advisers, and two (2) Senior Assistants, namely:

  • Hadiza Bala Usman - Special Adviser, Policy Coordination
  • Hannatu Musa Musawa - Special Adviser, Culture and Entertainment Economy
  • Sen. Abdullahi Abubakar Gumel - Senior Special Assistant, National Assembly Matters (Senate)
  • Hon. (Barr) Olarewaju Kunle Ibrahim - Senior Special Assistant, National Assembly Matters (House of Representatives)

Finally, di president don approve di appointment of Adeniyi Bashir Adewale as di Ag. Comptroller General of Customs.

Di statement note say make di appointed Service Chiefs, di Inspector-General of Police and di Comptroller General of Customs act for dia positions, pending dia confirmation in accordance wit di Constitution of di Federal Republic of Nigeria.