You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
‘I dobale for democracy’ - Tinubu react to June 12 celebration fall
Nigeria President Bola Tinubu don react to im fall during June 12 Democracy Day celebration.
Video of di president fall bin trend on social media. Tinubu bin wan enta di parade vehicle for Eagle Square for Abuja wen im miss im step and fall.
Afta di fall, di President quickly regain im balance and continue wit di event.
Wen im speak about di incident on Wednesday, e joke about am as e tok say im “dobale” (pay homage) for democracy as a "traditional Yoruba boy".
"Earlier dis morning (Wednesday) I bin get swagger and e dey on di social media. Dem dey confuse weda I dey do buga or I dey do Babariga, but na day to celebrate democracy while doing dobale for di day. I be traditional Yoruba boy, I bin do my dobale," e tok.
Bifor dis reaction, presidency bin tok say President Tinubu ‘no get issues’ afta im fall during di Democracy Day celebration.
President Tinubu wey be 72 years fall inside di vehicle bifor im aides rush to help am stand back up.
Dada Olusegun, special assistant to di president on social media say: “Mr President miss im step as im bin dey climb enta di truck for June 12 Democracy Day celebration and trip. Na mild misstep.’’
End of Di one wey oda users dey read well well
‘’Im immediately carry on wit di ceremonial rounds. No issues.” Olusegun add.
Di ceremony for Eagles Square na key event as part of di series of celebrations wey dey happun nationwide to mark Nigeria annual Democracy Day.
Tinubu closest challenger during last year election, Atiku Abubakar, don sympathise wit am
“I sincerely sympathise wit President Bola Tinubu ova dis unfortunate incident as im bin prepare to review di parade on Democracy Day. I hope say all dey well wit am,” Im write on X.
Anoda contender for di office of di president during di 2023 general elections, Peter Obi tok say im dey sad to learn of di president fall.
“I dey sad as I learn of President Tinubu unfortunate fall today. I wish am well. We achieve notin if we laugh about accident wey fit happun to any of us.”
Popular politician and activist Shehu Sani say no be big deal, im add say dat tin wey happun show say di president no different to anyone of us.
“No be Just President Tinubu, anybodi wey dey alive fit trip and fall; E don happun to President Biden and Fidel Castro bifor. Presidents na human beings and mortals.”
X user Arinze Odira say di fall dey "scary to watch".
Anoda Nigerian Charles Awuzie post for Facebook say im bin dey emotional afta im see di clip.
“Weda na President Biden or President Tinubu, I usually dey feel somehow wen human hurt demsef for dia place of service. I wish di president well.”
Special Adviser Information and Strategy to President Tinubu Bayo Onanuga say ‘’President Tinubu no be Superman. Na human being just like all of us.
"President Biden several times don slip in di last three years. Even di younger Barack Obama bin slip wen im be president. Political leaders na human being too. Dis slip no suppose detract us from di import of Democracy Day celebration", e tok.
While most Nigerians bin sympathise wit am, odas dey question im health status, wey im opponents bin raise during di campaign for last year general elections.