How di 24 hours work permit Canada introduce go take affect international students

Africans wey dey study for Canada

Wia dis foto come from, Getty Images

From September 2024, International students wey dey study for Canada go now fit work for 24 hours off campus per week.

Di Minister of Immigration, Refugees and Citizenship Marc Miller give di announcement.

E say di temporary policy wey allow international students to work more dan 20 hours off campus go end for 30 April, and dem no go extend am.

During di Covid-19, di goment bin temporarily lift di 20 hour cap on work hours for international students to fit work. But dat temporary policy waiver go end on 30 April, 2024.

Di immigration oga say from 1 May, 2024, off-campus work hours for international students go return to 20 hour-per-week-limit. However for September 2024, e go increase go 24 hour per week limit.

Di reason goment introduce reforms “working off campus go help international students gain work experience and clear some of dia expenses.” Oga Miller add.

E say dis new reform na to ensure say students wey come Canada for study must focus on di reason dem come, and to protect dem from fraud and financial vulnerability.

“Students wey come Canada must come to study. As such, allowing students to work up to 24 hours per week na to ensure say dem focus primarily on dia studies, while dem get option to work if necessary.”

Meanwhile, students wey get “scheduled academic break” fit continue to work unlimited hours as summer go soon start, DI Immigration oga add.

Why Canada increase di time international students go fit work

Students for university dey graduate

Wia dis foto come from, Getty Images

Canada goment say di reason why dem change di time na becos dem look di needs of di students, di policies of oda kontris, plus research show say di academic performance of student wey dey work while studying dey suffer.

“Recent studies dem conduct for US and Canada don show say decline in academic performance dey for students wey dey work more dan 28 hours per week, plus say make student work more dan 24 hours per week fit increase di chances say di student fit drop out of dia program.

For December 2023, di Government of Canada bin raise di cost of living standards wey students must meet before dem fit dey approved for study permit so dem go financially dey prepared for life in Canada and no be dependent wey dey work.

Most kontris wey welcome international students bin set limit on di number of hours dem fit work as dem dey study.

Australia bin recently change dia policy to allow student to work 48 hours every 2 weeks.

For US, students must meet additional criteria before dem fit dey permitted to work off campus at all.

Di goment further add say international students wey begin college program wey come through public-private curriculum licensing arrangement on or after May 15, 2024, no go dey eligible for post-graduation work permit wen dem graduate.

Those wey don already start dis kain program bifor May 15, 2024, go still fit access post-graduation work permit, in as mucn as dem meet oda criteria.