FG confam death of Nigerian student for Canada afta police shoot am

Afolabi Stephen

Wia dis foto come from, NIDCOM

Wetin we call dis foto, Di late Folabi Stephen wey police for Canada allegedly kill

Nigeria goment don vow to make sure say one 19-year-old Nigerian student wey police allegedly kill for Canada get justice.

Chairman of di Nigerians in Diaspora Commission, (Nidcom) Abike Dabiri-Erewa, describe di alleged killing of di Nigerian student for Manitoba, Canada, Afolabi Stephen, as "wicked".

Inside statement wey di commission release on Thursday 4 January, 2024, wey di Director of Media and Public Relations and Protocol sign, di commission promise say dem go make sure say justice dey served.

"Di Nidcom boss receive di news wit shock. We dey in touch wit di Nigerians mission for Ottawa wey don get di assurances of di Canadian authorities say dem don start investigations into di unfortunate incident.

We offer our deepest condolences to di family and friends of Afolabi and pray unto God to allow im gentle and innocent soul to rest in perfect peace".

How Afolabi Stephen take die

According to di Nidcom statement, tori be say na policemen shoot di 19-year-old Nigerian, Afolabi Stephen, on December 31, 2023 for Manitoba, Canada.

Even though di details of im death neva dey clear like dat, di Winnipeg, Manitoba Police Department for statement wey dem post for dia website via Winnipeg.ca, say " dia officers bin respond to one call about one young man wey bin dey act “erratically” (behave anyhow).

Di police note say wen dem arrive, efforts to calm di young man no work, e con make di police to shoot, wey lead to im ultimately death.

Winnipeg Police

Wia dis foto come from, Screenshot

Wetin we call dis foto, Winnipeg Police post on dia website about di incident

Di death of Afolabi Stephen don dey bring back conversations about how safe students for abroad dey.

And pipo don dey begin ask question why di policemen go use firearm (gun) to calm pesin down.

Di no be di first time tori of how students wey go study dey die for foreign lands sake of one reason or di oda.

For January 2022, one Nigerian student wey dey 19 years die for Ukraine Fadlullah Agboluaje, bin die for im room one day afta e arrive di European kontri to study.

Tori be say na di school representative bin pick am from airport, and dem find am dead for ground inside im room.

Richard wey dey 19 years bin miss from im house for Ladbroke Grove on Monday, 22 March. and dem report am missing on Wednesday, 24 March.

For September, 2023 on Nigeria student wey bin dey travel to go school abroad also die inside aeroplane.

Tori be say she bin sick onboard di flight.