Wetin we know about di mass shooting wey kill fifteen students for Prague university

Policemen

Wia dis foto come from, Getty Images

At least 15 pipo don die and dozens wunjure for shooting wey happun for one university for Central Prague, Czech police tok.

Police say dem don eliminate di gunman and di building don dey empty.

Di incident happun for Charles University, wey dey for Jan Palach Square.

Di gunman na student for di faculty of arts wey dey di university, police tok.

Members of emergency service

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Members of di emergency services prepare to help dozens of pipo wey wunjure

Around 15:40 Prague time (14:40 GMT), reports begin comot about di mass shooting for Czech capital.

Police tok say dem dey respond to di incident wey happun for di faculty of arts of Charles University, for central Prague, and tok say several pipo don die or wujure.

For one post on X, formerly Twitter, di Czech president, Petr Pavel, tok say im dey "shocked by di events" for Prague and e dey express im "sincere condolence to di family and relatives of di victims".

E also tank Prague residents for "respecting di instructions of di security forces".

Czech media report of blast and gunman ontop roof

Prague emergency service tok say dem don send "large number of ambulance units" to di faculty of arts of Charles University for central Prague, dem add say di injuries range from light to veri serious ones.

Di Czech Republic Nova TV station report say di blast happun and one gunman dey ontop di roof of di building for Prague centre.

Interior Minister Vit Rakusan say "dem neva confirm any oda gunman” as im ask pipo make dem follow police instructions.

Police don close di area and dem dey ask pipo wey dey live nearby to stay for house.

Dem find gunman lifeless for university faculty

Dem find di gunman "lifeless bodi" for di university, di police president tok.

According to di police, di gunman na 24-year-old from one village wey dey 21km (13m) outside Prague.

Police say add say di shooter dey inspired by similar mass shooting wey don happun abroad.

Di mass shooting no dey linked to international terrorism, Vit Rakusan, di Czech minister for interior, tell tori pipo.

Police also tok say dem find di gunman papa deadi bodi today.

'We hear gunshots and run for cover'

Joe Hyland, 18, from Truro, Cornwall, dey on holiday wit im friends for Prague and e dey close to di street wia di attack happun, wen im hear di shooting.

"We hear gunshots and run for cover for di metro afta police shout make evri one run. E dey veri scary.

"All of a sudden pipo start to dey run. We no know wetin dey happun. We see police dey pass us. Dem dey shout ‘run’.”

Hyland don go back to im hotel safe.

"We ring our parents phone straight away. Dis na our first holiday wit just us lads.”

Police officer

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One police officer secure di area afta di shooting for one of di buildings of Charles University for Prague

Worst deadly shooting for modern Czech history

Thursday afternoon attack for Charles University arts faculty na di worst deadly shooting since Czech independence 30 years ago.

Di recent gun attack happun for December 2019 for hospital for Ostrava, wen one man open fire for trauma clinic waiting room and kill four men and two women, bifor im turn di gun on imself.

For February 2015 one local man open fire for restaurant wey dey eastern town of Uhersky Brod. Eight pipo die for di attack.

Even though gun attacks no dey happun for Czech Republic, hunt game wit guns dey popular. For 2019 di Czech goment try in vain to overturn one EU ban on semi-automatic rifles for private use wey dem bring in afta series of deadly jihadist attacks across Europe.