NDC candidate Ewurabena Aubynn win controversial Ablekuma north rerun election for Ghana

ewurabena

Wia dis foto come from, EWURABENA AUBYNN/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Ewurabena Aubynn bin win di seat for di NDC for di first time ever
Read am in 8 mins

Di parliamentary candidate for di govment national democratic congress (NDC) don win di controversial Ablekuma North constituency election rerun.

Dis na afta di electoral commission organize polls for 19 polling centers wia di commission tok say gat irregularities.

Ewurabena Aubynn don defeat her opponent di new patriotic party (NPP) candidate Nana Akua Owusu Afriyieh for tense election wey see plenty chaos and tension.

Bifor di rerun on Friday, na 6800 eligible voters dey expected to vote for di 19 polling centers.

Di electoral commission on Thursday bin tok say from di votes dem collate from di 262 polling centers out of di total 281 centers, di opposition NPP candiate madame Akua Afriyie bin dey lead wit 48 votes bifor di rerun of outstanding 19 centers.

According to di EC, Akua Afriyie bin get 32,512 votes compared to di govment NDC candidate Ewurabena Aubynn im 32,464 votes.

Di rest of di 19 polling centers, di EC decide to rerun di election dia sake of plenty irregularities wia dem lose original result sheets sake of chaos wey happun for di December 7 vote.

Afta di electoral commission collate all di results for di 19 stations togeda wit di ones dem collate already, dis na di final results -

Akua Owusu Afriyie (NPP) - 33,881

Ewurabena Aubynn (NDC) - 34,090

Rejected ballots - 411

From dis result, Ablekuma north finally get representative for parliament.

Na she be Ewurabena Aubynn of di NDC; to add to di 183 seats di govment party already bin get

In total di NDC gat 184 MPs compared to di NPP im 83 seats.

Di MP-elect Ewurabena Aubynn tok say "justice dey served, afta di long battle."

"I tank di constituents for dia trust and how dem dey vigilant for dis election to ensure say we don win am."

Dis be di first time di NDC bin win di Ablekuma north seat for dia history as di NPP bin dey win am since he 1996.

But dis election rerun come wit plenty choas and drama

At least two journalists don suffer attacks from one police officer and some party thugs.

Di Ghana journalist association bin condemn di attack on di journalists.

"Di GJA dey condemn di assault by di police divisional officer wey attack di journalist and di party supporter wey attack anoda journalist."

"We bin dey call on di police to punish di officer and oda pipo wey attack journalists during di election rerun. We go offer our support to dis journalists," di president of di GJA oga Albert Dwomfuor tok for one press conference.

Di party supporters also bin attack one former minister for fisheries Mavis Hawa Koomson wey bin show up for one poll in center.

Dem also attack one deputy organizer of di opposition NPP.

For viral videos on top social media, di macho men don enta di polling center wia dem try to remove di former NPP minister Koomson by force.

Na so she bin use pepper spray to try to protect herself but di supporters don plenty wia dem attack am.

Di opposition NPP bin condemn di chaos and violence wey happun for some polling stations.

Akua Afriyie and Ewurabena Aubyn

Wia dis foto come from, NANA AKUA OWUSU AFRIYIEY/EWURABENA AUBYN/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di electoral commission rerun di election for 19 out of over 231 polling centers for di Ablekuma North constituency

Former vice president Dr Mahamudu Bawumia don call on di police to arrest di pipo wey cause di kasala and put dem bifor court.

Some govment officials also bin condemn di violence.

Earlier police don release statement say dem withdraw one police inspector Lumor wey bin dey captured on video say im slap one journalist.

Di police tok say dem interdict am wia im begin dey face disciplinary committee.

But sabi pipo tok say di police bin handle dis election rerun poorly; Sake of di violence and chaos don plenty across di 19 polling centers.

Dem bin dey tok say dis one don show wetin to expect for di Akwatia constituency for di eastern region wia one NPP lawmaker don die last week.

Di electoral commission gat to organize bye-election for dat constituency.

From history, bye-elections for constituencies for Ghana bin dey tencious and chaotic.

Di police gat to assure pipo say dem dey on top of dia work to ensure say di chaos and violence for di Ablekuma north constituency no go repeat.

As voting dey happun

Voting for di 19 polling centers for di Ablekuma North constituency for Ghana don dey happun now.

For some voting centers, kasala happun as one police officer slap one journalist on duty.

Di reporter wey dey work wit GhOne TV for Accra im face don scratch afta di slap from di officer wia bin dey captured for one viral video

In di last few minutes, di police administration don issue statement wey dem interdict di police inspector Lumor wey slap di journalist.

"We don withdraw di officer from di election duty for Ablekuma north. In line wit police discipline procedure, we don interdict di inspector," police tok for statement.

For anoda polling center for Odorkor Methodist church, free-for-fight don break out.

Some thugs wey be party supporters don storm di center wia dem attack pipo including di policemen, one former minister for fisheries Mavis Hawa Koomson and odas.

Dem bin push di former minister for ground; according to di pipo, she no get any business for dat constituency wey dem accuse her say she pull pepper spray afta dem allow her to enta di polling center.

Inside viral videos, di fight last for many minutes bifor security don cool di situation.

Di kontri defense minister and interior don visit di area to understand wetin dey happen for dia.

Dem appeal for calm as di voting dey continue

Calm don return to dat particular pilling station wey voting dey continue.

All eyes dey for one constituency for Accra - di Ablekuma North constituency as di electoral commission for Ghana organize election rerun for dia.

Di kontri election management body announce say dem go do rerun for di polls for 19 out of di 281 polling centres sake of dem no fit authenticate di results for dis places.

According to di commission, both di goment party di national democratic congress (NDC) and di opposition new patriotic party (NPP) no gree for di results of plenty polling centres during di collation.

Di goment party NDC tok say di electoral commission gatz do rerun di vote for 37 polling centres sake of result sheets wia di EC bin use for collation, na scanned copies wia di opposition NPP don present.

Di NPP also tok say di goment NDC agents bin verify those scanned copies dem present wey dem carry collate di votes afta di election.

Na so di only centres wey dey outstanding na 3, wia di electoral commission gat to collate and declare di winner.

But di electoral commission inside one statement on 2 July tok say dem go return di vote for 19 out of di 37 centres.

Akua Afriyieh

Wia dis foto come from, NANA AKUA OWUSU AFRIYIEH/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di NPP candidate Nana Akua Owusu Afriyieh say she win di december election wit 414 votes

Chaos happun afta di voting, angry supporters burn electoral materials

burnt school

Wia dis foto come from, NTAKOR NATION/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Angry supporters bin allegedly burn one school wia electoral materials bin dey afta di vote

Afta di elections on 7 December for di Ablekuma north constituency, kasala don happun.

Thugs wey pipo sabi as angry party supporters bin storm di collation center wia dem attack EC officers.

Dem destroy di result sheets of di officers wia dem carry some of di ballot boxes away.

Na so many of di presiding officers don lose dia result sheets.

In fact, one basic school wey dey close to di collation center wia dem keep di ballot boxes and oda materials bin catch fire.

Di fire don scata di electoral materials and all di ballot boxes wia fit serve as reference for some of di vote tally for some polling stations.

Normally afta di electoral officer supervise di counting and collation of di vote, dem dey record di figures on top one result sheet (pink sheet).

Di sheet gat carbon copies na so dem go give one to di agents of di candidates wey bin stand for dat election.

Dis agents go sign on top di result sheet if dem all gree say di results be verified

For di case wia di electoral commission no get dia own original copy of di tally sheet, dem fit rely for di carbon copies from di agents.

But for dis instance, di goment party NDC say dem gat dia carbon copies of di results wia di NPP bin submit scanned documents, wia di NDC don reject.

Di NDC tok say dem no fit verify di figures on top di NPP scanned documents, na so dem call for rerun of di vote.

Six months na long time for pipo of one constituency to dey without lawmaker sake of di kasala wey happun for there.

Governance pipo say dis kind tin no be good for di kontris democracy and image .

For 2020, di electoral commission prevent Santrokofi, Akpafu, Lolobi and Likpe (SALL) pipo from voting during di general elections.

As a result, di pipo of SALL neva get representative for parliament for 4 years.

Pipo carry di mata go di Supreme Court but till now di apex court neva finish di mata (5 years later).

President John Mahama during im campaign ahead of di 2024 elections describe di tin as "cardinal sin for di fourth Republic of Ghana."

Sabi pipo say di denial of di SALL pipo dia representation for parliament go go down in history as crime wia di electoral commission don commit against di pipo.

For di 2024 elections however di SALL pipo bin vote wia dem now gat representative for parliament.

Ewurabena

Wia dis foto come from, EWUARABENA AUBYN/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di NDC candidate Ewurabena Aubyn say na she win di december election