CBEX resume back wit investors money for dia account but no withdrawal

Read am in 4 mins

Months afta CBEX bin crash, many investors don begin see dia balance for dia CBEX account but as di money don appear dem no fit withdraw am.

Di platform claim say investors go need deposit $200 to withdraw funds above $1,000 while funds below $1,000 investors go need deposit $100.

Checks from BBC Pidgin show say di platform ask investors make dem login into dia account do dem go fit reclaim dia money.

One of di victim inform BBC Pidgin say im dey see im money but e no fit withdraw am back as cash.

E tok say investors account don dey active but e dey impossible for dem to withdraw dia money.

Di Economic and Financial Crimes Commission bin don announce say dem arrest some suspects in connection wit di scheme, while dem assure di victims say dem still dey conduct investigation.

Inside one interview, Ola Olukoyede, Chairman of di Economic and Financial Crimes Commission, tok say dem don investigate 58 pyramid scheme.

"We don go far on CBEX but we need make pipo know say e dey appeal to di greed of di pipo make Nigerians dey careful becos any business wey tok say e go give pipo double your money in three months run comot from am," e tok.

For April, many Nigerians bin lose dia money to CBEX afta di platform bin promise dem say dem go get 100 percent return on dia investment.

Tori be say na ova 1.3 trillion naira ($809,000) CBEX sweep comot from investors accounts, afta dem suddenly stop dia operations and investors no get access into dia accounts again.

So far, EFCC don declare some of di operators of CBEX wanted for Nigeria and di commission tok say dem don recover some money back.

How to avoid falling for CBEX trick again

As di platform don restore dia app, dem want new investors and dem want make old investors put money back into di ponzi scheme.

According to Federal Bureau of Investigation report e advise pipo make dem no rush into any investment scheme, make dem do dia findings bifor dem put dia money becos Ponzi Scheme dey always want di money of new investors to pay new investors.

FBI tell pipo say na just make believe say di investment dey safe na why dem dey show pipo dia account balance but na trick to lure money pipo into investment.

Di agency advise say make pipo ensure say dem get unbiased third party financial adviser bifor dem go invest dia money.

FBI tell dem make dem inform di state security regulators so dem go fit conduct dia investigation to check if di investment platform dey genuine or e just wan trick pipo out of dia money.

How to protect yourself from fake investments - SEC

Also, Securities and Exchange Commission in Nigeria warn for sign of scam for dia website. Di commssion list out some of di signs wey pipo need to look out for make dem no fall for di trick of dia ponzi schemes.

  • Any platform wey you dey pay money to get more money
  • Wia dem dey send you code from you phone, make you send give dem
  • Wia dem promise you instant wealth wit no effort
  • Deal wey dey sound too good to be true
  • You dey pressurise to act fast without time to tink about di investment
  • Wia dem dey make request of too many personal information.
  • Make you secret millionaire
  • Dem dey make free offer of gifts but you go need pay first
  • You go need register pipo bifor you fit get di prize you win
  • Unexpended inheritance from close relative wey you no dey aware about.
  • Guarantee profits wit no risk
  • Payment only via crypto
  • Shady-looking website
  • Di receiver no dey provide verifiable contact info or account details ? Scam.
  • Wen di platform dey too secretive and dem dey tell you make you no dey discuss di matter wit odas.
  • Experts wey dey tell you make you avoid legal means of investment.
  • Understand di nature of di investment bifor you put money
  • If dem no fit explain di business wey go bring di returns for di scheme
  • Check if di product or service di company dey sell dey genuine
  • Check weda di rate of returns dey sustainable.
  • Try dey avoid any investment wey you no understand and dem no fit explain give you like small pikin make you for understand.