You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Uefa Champions League prediction, team news & kick off
Manchester United dey eye dia first win for di group stage of di Champions League dis season wen dem host FC Copenhagen on Tuesday evening.
Di Reds Devils don lose dia opening two games against Bayen Munich and Galatasaray.
Based on dis result, Erik Ten Hag team dey siddon for di bottom of dia group.
Bayern Munich dey top di group wit six points followed by Galatasaray wit four points and FC Copenhagen dey third wit one point.
While Man United no get any point for table.
Di top two teams go qualify for di round of 16 while di team wey finish third go, drop to Europa League.
Tuesday and Wednesday go see a total of 16 games for Europe biggest club competition.
Checkout prediction, team news for Man united, Arsenal and Real Madrid fixtures.
End of Di one wey oda users dey read well well
Man United vs Copenhagen prediction
‘’Dis na must-win game for Man Utd’’ na wetin football sabi pesin Bolarinwa Olajide tell BBC Pidgin.
‘’Afta two defeat, dem don dey run out of games. Dem need to bounce back for di competition’’ Bolarinwa add.
‘’Copenhagen na very tough team to beat especially wen dem dey play away from home, and dem fit capitalise on Man Utd’s poor start to di season’’. E kotinu.
Dis fit be anoda tough night for Man Utd, but dem get goal threats from all areas for dia team. I dey expect tight game, but di Red Devils go win.
Prediction: Man Utd 2-1 Copenhagen
Man United vs Copenhagen Team news ( 9pm West African time)
Man United: Onana; Dalot, Varane, Maguire, Lindelöf; Amrabat, McTominay; Antony, Bruno Fernandes, Rashford; Højlund
Players wey dey out: Diallo, Casemiro, Mainoo, Malacia, Martínez, Shaw, Wan-Bissaka
Players wey fit no play: Evans, Reguilón
Copenhagen: Grabara; Ankersen, Vavro, Diks, Sørensen; Lerager, Falk, Gonçalves; Elyounoussi, Claesson, Achouri
Players wey dey out: Clem, Cornelius, E. Højlund, Meling
Players wey fit no play: Boilesen, Khocholava
Players wey go miss next match if dem collect card: Lerager, Meling
Sevilla vs Arsenal
''Dis game go tight, but Arsenal get better players and better squad.
I dey surprised say Sevilla dey struggle so far dis season.
Dia form surprise me based on how well dem bin dey play towards di end of last season''. Bolarinwa tok.
Di draw against Real Madrid on Saturday for La Liga go ginger dem against Arsenal.
Arsenal bin need to dig deep to get draw for Chelsea on Saturday.
''Based on di kain players di Gunners get for bench, I dey tip dem to bounce back and win''.
Prediction: Sevilla 1-2 Arsenal
Sevilla vs Arsenal( 9pm West African Time)
Sevilla: Nyland; Jesús Navas, Gudelj, Ramos, Acuña; Soumaré, Sow; Ocampos, Rakitić, Lukebakio; En-Nesyri
Players wey fit not play: none
Arsenal: Raya; White, Saliba, Gabriel, Zinchenko; Ødegaard, Rice, Partey; Saka, Jesus, Martinelli
Players wey dey out: Timber
Players wey fit no play: none
Braga vs Real Madrid
''Braga go carry dia fine form enta dis game. Dem get players wey fit worry Real Madrid.'' Bolarinwa tok
''I dey expect dem to ginger Real Madrid well-well. But Real Madrid class, mentality. quality and experience go allow dem to secure di maximum points''. E add.
Braga don win one match for di group stage.
Prediction: Braga 2-3 Real Madrid
Braga vs Real Madrid (9pm West African time)
Braga: Matheus; Borja, Niakaté, Serdar Saatçi, Mendes; Al Musrati, Zalazar; Bruma, Álvaro Djaló, Ricardo Horta, Banza
Players wey dey out: none
Players wey fit not play: Victor Gómez
Real Madrid: Arrizabalaga; Carvajal, Rüdiger, Alaba, Mendy; Valverde, Tchouaméni, Camavinga; Bellingham; Joselu, Vinicius Júnior
Players wey dey out: Courtois, Éder Militão, Arda Güler
Players wey fit not play: Ceballos