Godwin Emefiele: Arraignment of di suspended CBN governor no hold as court schedule

Oga Emefiele anf im lawyer

Di arraignment of di suspended Central Bank of Nigeria govnor, Godwin Emefiele no hold as scheduled on Wednesday.

Emefiele suppose take im plead for court today but surprisingly di Registrar for court confam to tori pipo say di case no dey for dia cause list.

Dis one mean say di case no dey among di cases dem go hear for di day. E no too clear for now why dis case no dey among.

Neither Oga Emefiele's lawyers nor di prosecutors- di State Security Service (DSS) dey for court and dem no give reasons for di absence of di case on di court case list.

Di DSS neva respond to di BBC request for comment.

Last Thursday, Justice Hamza Muazu of di Federal Capital Territory (FCT) High Court bin adjourn di arraignment of di former Emefiele to 23 August 2023 afta counsel to Nigeria Goment Muhammed Abubakar beg court to adjourn am sake of say one of di defendant Sa'adatu Yaro no showface sake of say she sick.

Charges wey FG sama Emefiele

Nigeria goment sama Emiefiele and im alleged partner 20 charges of procurement fraud, conspiracy and giving corrupt advantages to im associates.

Di suspended CBN oga chop accuse say e give mago-mago advantage to Sa'adatu Yaro wey be director for April1616 Investment Limited.

Dis offense dey against Section 19 of di Corrupt Practices and oda Related Offenses Act 2000.

Di section for di act say "Any public officer wey use im office or position to give any corrupt or unfair advantage upon imsef or any relation or associate of di public officer or any oda public officer, dey guilty of an offence and wen dem convict am, im go dey liable to imprisonment for five years without any option of fine"

Director of public prosecutions, federal ministry of justice, Mohammed Abubakar and oda Ministry officials na im sign di charge sheet.

Dem allege say di three of dem buy a fleet of over 98 exotic cars and armoured buses wey cost around N6.9 billion.

Dem buy some of di cars and buses between 2018 and 2020, di charge add.

Di cars include 84 Toyota Hilux vehicles, 10 Armoured Mercedes Benz buses, 2 Toyota Landcruisers and one Toyota Avalon car.

One of di counts tok say Godwin Ifeanyi Emefiele sometime around 2018 use im position as govnor of Central bank of Nigeria give corrupt advantage to Sa'adatu Yaro as im award her contract to supply 37 Toyota Hilux vehicles wey cost N854,700,000 only to April1616 Investment Limited.

Anoda charge be say Emefiele still give Sa'adatu Yaro anoda contract to supply one Toyota V8 Landcruiser at di cost of N73,800,000 only and Toyota Avalon at di cost of 99.9 million to April1616 Investment Limited for 2019.

Dem also allege say Emefiele still give anoda contract to Yaro to buy one Toyota Landcruiser VXR wey dem value at N96 million for 2020.

Sa'adatu Yaro go also ansa question for court for allegedly committing punishable offence as dem also accuse her say she use mago-mago buy property afta she get CBN contract to supply 47 Toyota Hilux vehicles at di cost of N1,085,700,000 plus oda tins.