Godwin Emefiele: DSS move to withdraw 'fire arms' charge against ex-CBN governor wit 20 fresh charges

Godwin Emefiele

Nigeria goment say dem don file fresh charges against di suspended govnor of di Central Bank of Nigeria Godwin Emefiele.

Director of Public Prosecutions (DPP) for di federal ministry of justice, Mohammed Bakodo Abubakar tok dis one as e dey address tori pipo for court on Tuesday.

Dem bin hear Emefiele case for di Federal High Court Lagos.

Di federal goment through di Department of State Security (DSS) begin process to withdraw dia charges against di suspended govnor of Central Bank of Nigeria.

Dis na di new matter wey hapun for di court on Tuesday wen DSS bin file anoda application against di former CBN oga.

Na wen oga Abubabaker dey tok im reveal say goment say dem don file anoda 20 count charge against Emefiele for Abuja.

Although Emefiele no show for court, im lawyer tok say dem no go gree all di applications wey goment make on dia move to withdraw di 'fire arms' matter.

Afta two months di Department of State Services (DSS), still dey hold di former govnor of Central Bank of Nigeria (CBN), Godwin Emefiele, for dia custody despite say Justice Nicholas Oweibo grant am bail of N20m on 25 July.

Bifor den Justice Hamza Mu'azu of di Federal Capital Territory High Court on 13 July bin order di secret service to charge Godwin Emefiele to court within one week or make dem release am.

On 7 August, di tok-tok pesin of DSS Peter Afunanya tok say dem re-arrest di former govnor of CBN base on a magistrate court order, wey tok say make Emefiele remain for dia custody as dem dey investigate am base on "adequate suspicious of commission of a crime."

Wetin Emefiele lawyer tok

For im reply, Joseph Daudu (SAN) wey be defence counsel to Emefiele tok say evri tin wey federal goment and DSS dey do be like feem.

Im tok say dem neva see di application wey mean say dem no fit deal wit am.

Emefiele lawyer tok say wetin dey ground na di violation of court order wey happun for July 25 wen court bin grant di suspended govnor bail but DSS no allow.

"E dey obvious say dat disrespect wey DSS show no go dey washed away like dat, we we gatz address am bifor any oda step including di withdrawal of di charge. We no go allow make anybody use di court as tissue paper"

Di lawyer tok say dem no gree becos di law tok am bifor dem go fit withdraw any case, e gatz dey for di interest of justice and not abuse of court process.

Im add say no oda step go take place until dem address di disobedience to court order unless di court overlook am.

Justice Nicholas Oweibo Di case dey adjourn di matter till Thursday 17 August.