MC Oluomo latest news: NURTW chairman react to suspension as Governor Babajide Sanwo-Olu ban di union from all parks and garages

Lagos state goment don suspend di National Union of Road Transport Workers, NURTW from Lagos parks and garages.

Dis na sake of di kasala wey dey play out for di Lagos chapter of di union ontop leadership mata.

Before goment order, Musiliu Akinsanya wey popularly known as MC Oluomo come out to say im don resolve to withdraw di membership of di Lagos chapter from di National Union of Road Transport Workers

Dis dey come afta di National body of transport workers for Nigeria suspend am from di union sake of alleged misconduct.

MC Oluomo wey be chairmo of di NURTW for Lagos say na on behalf of di Lagos chapter im withdraw dia membership.

"In order to promote peace, harmony, legality, I, Musiliu Akinsanya, on behalf of all members of di National Union of Road Transport Workers(NURTW), Lagos State chapter, wit over 200 units, don write to di Lagos State Ministry of Transportation and other relevant Agencies about our decision", im tok for inside statement.

Quoting di section 40 of di Constitution of Federal Republic Nigeria 1999 (as amended), im say: "Every pesin dey entitled to assemble freely and associate with other pipo, and in particular im fit form or belong to any political party, trade union or any association for di protection of im interests."

E also ask Lagos State Government to take over di running of di affairs of di Union wit di constitution of a Park Management Committee for Motor Garages & Parks for inside di State to maintain peace.

Wetin Sanwo-Olu tok?

Inside statement Lagos state goment release, dem say dem don dey watch di plenti back and forth wey NURTW dey do as to di leadership of di union.

Di statement say to prevent kasala and protect citizens of di kontri dem need to chook mouth to douse tension.

"Afta considering di provisions of di law di goment hereby suspend di activities of NURTW, wey must cease to operate in all parks and garages for Lagos," di statement tok.

Why NURTW suspend MC Oluomo?

Di National Union of Road Transport Workers (NURTW) suspend di Lagos chapter Chairman, indefinitely over 'alleged misconduct, insubordination, and inciting members' of di state chapter against di national body.

Dis development fit dey connected to one protest wey Mc Oluomo supporters do wey dem accuse di union at national level say dem dey unnecessarily interfere for di State affairs.

NURTW also direct MC Oluomo to immediately hand over leadership to im deputy chairman and release all property wey belong to di transport body wey dey im hand to di State Secretary, so as to avoid any leadership vacuum for di state.

Dem allege say di decision to place MC Oluomo on indefinite suspension na to prevent any breakdown of law and order after dem notice say im already dey incite members against di union, an act wey dey completely against NURTW constitution.

MC Oluomo suspension dey for one letter dem send am ontop decisions di national body don take as e concern im recent conducts wey di Union describe as a total disregard for di constitution wey dey govern members activities across di country.

For di letter wey dey dated March 9th, 2022, di national body say dem resolve to suspend MC Oluomo after e become obvious say MC Oluomo no dey sorry over im actions even after dem direct am to explain reasons for embarking on such.

According to di letter wey di General Secretary of di national body, Kabiru Yau sign, di Union promise to ensure say di NURTW constitution remains sacrosanct and members dey abide by am across di country.

Who be MC Oluomo?

MC Oluomo wey im real name na Musiliu Ayinde Akinsanya na Nigerian socialite wey also be di chairman of di Lagos chapter of di National Union of Road Transport Workers (NURTW).

Tori be say dem born am on March 14, 1975 MC Oluomo dey married to three wives and e get nine children.

E don make headlines in recent year sake of different reasons and e dey popular well-well becos of im work wit di union and as pesin wey get leg for Lagos even for im politics.

During di End Sars protest against police brutality, protesters reject food, water and drinks wey MC Oluomo carry come give dem for Alausa, Ikeja, Lagos state, Nigeria.

For di video wey go viral for social media, di protesters dey shout say dem no want MC Oluomo food or drinks and make di white van wey carry di tins come move comot from wia dem dey.